Kano assembly revoke di emirates council law wey Ganduje bin amend

Kano state House of Assembly

BBC

Kano State House of Assembly don cancel di old law wey Ganduje government make for 2019, wey create five emirs for Kano.

Di assembly den pass di Kano state emirates council law 2024 afta di third reading.

Di new law nullify offices wey dem establish – also di district heads wey dem promote go return to dia former positions.

Di lawmakers bin debate di mata on Thursday bifor dem agree to cancel di old law and go back to di single emirate wey don dey for Kano for over 900 years.

“We don cancel di law wey create di five emirs for Kano, which mean say no emir dey for Kano entirely again.” Di majority leader for di assembly, Lawan Hussaini Dala, tok dis one for interview wit BBC.

He add say di assembly don dissolve all di five emirates, meaning say no emir go dey for Kano once di governor sign di law.

E explain say di oda emirates don downgrade to second-class status, and di new law go get di first reading.

However, dis cancelation neva become law until di Kano State Governor, Abba Kabir Yusuf sign am.

Ayuba Labaran

BBC
Ayuba Labaran, minority leader for Kano Assembly

Ayuba Labaran, di leader of di minority members for di assembly, waka commot from di session afta di speaker suspend am for criticizing di motion.

Labaran tok say, “Dem dey claim say di emirate don tey for over 900 years, but if we look back, di population of Kano no go don pass 200,000 pipo.”

E add say wen dem introduce di law to create extra emirates for Kano during Ganduje tenure, di four areas wey dem create new emirates see progress in terms of infrastructure and oda amenities.

Kano State House of Assembly propose to amend di law wey divide di Kano Emirate into five smaller emirates wey dem implement for 2019.

Di Assembly carry di amendment issue afta di Leader, Lawan Hussaini Dala, present di motion for Assembly on Tuesday, and dem read am for di first time on Wednesday.

For 2019, former govnor of Kano state Abdullahi Ganduje, present one bill for di State House of Assembly to create four new emirates.

But, di court reject di creation of di four new emirates, say dem no follow procedure to make di law.

For May dat year, govnor Ganduje sign di bill into law, create di new emirates of Gaya, Rano, Karaye, and Bichi – all of dem get district heads under di Kano Emirate.

For di same month, e remove di 14th Emir of Kano, Sanusi Lamido Sanusi, and appoint new emirs for di newly created emirates.

Kano state House of Assembly

BBC

Despite dis, di Kano state goment claim say dem neva receive any official court order to stop di creation or di appointment of di new emirs.

Di former govnor tok say di reason for creating di new emirates dat time na to unify di community, improve security, and promote development for Kano State.

Di Commissioner for Information under Ganduje administration, Muhammed Garba bin explain say some of dis emirates dey bifor di Kano Emirate, and dis move na effort to revive dem.

Di law get 51 provisions, as di Kano State House of Assembly tok during di amendment process for 2019.

Some key provisions inside di old include;

  • Di governor go get power to select di chairman of di council of emirs to be established later.
  • Di governor go appoint kingmakers wenever di need arise.
  • Any Emir wey di governor choose to lead di council of emirs go serve for two years.
  • Any emir wey fail to attend di council meetings three times witout valid reason go lose im throne.

Bifore di 2019 law, na di colonial “Emirs Deposition and Appointment” law dem dey use to remove emir from im throne and send am to anoda town.

Source