Goment introduce portal in effort to bridge shortage of housing in Nigeria – how you fit apply

For most developed economies, di housing sector na one important sector wey dey bring about economic growth.

For Nigeria, however, access to affordable housing na dream wey neva come true for plenty citizens, most especially, di ones wey dey middle and the lower classes of di society.

Di issue of housing deficit don grow from bad to worse and different governments from di time of Nigeria independence till date still dey grapple wit di problem and dem neva see solution to am.

According to di International Human Rights commission IHRC, more dan 28 million Nigerians lack access to decent and affordable housing, and dis na di same wit how do Federal Mortgage Bank of Nigeria (FMBN) take reason am, di Bank say say Nigeria go need at least 28 million housing units to close di Housing gap.

However, the challenge no start today. Nigeria housing situation don grow well-well from 7 million housing units for 1991 to 12 million for 2007, 14 million for 2010 and subsequently 28 million housing units for 2022.

Growing urban population plus lack of efficient mortgage system, poverty, increasing construction costs, high inflation and declining household income, don make access to decent and affordable housing dey difficult for many Nigerians.

Di Central Bank of Nigeria for 2019, tok say na only 10% of Nigerians wey wish to get dia own house fit afford am.

Di right to beta housing wey dey safe, secure, healthy, available and inexpensive dey inside di Habitat Agenda and di goal na to provide adequate shelter for all (UN Habitat, 2001).

According to Pison Housing Company (2010), na about 10.7 million houses dey for Nigeria, irrespective of di policies, organisations and regulations wey di Nigerian government don put in place since independence for 1960, shortage of housing still dey, especially for the low-income segment of di society.

Sake of dat, Nigeria government don launch one online housing portal wey go enable Nigerians, within and outside di kontri fit easily buy house or get house on mortgage without wahala.

Dem call am di Renewed Hope Housing Delivery Portal.

Di Minister for Housing and Urban Development, Ahmed Dangiwa for one statement on im X (former Twitter) account say goment officially open di portal on Tuesday 22 May.

Oga Dangiwa tok say na “state of di art web portal wey dem design to enhance di delivery of di Renewed Hope Estates and Cities Program.”

E explain say goment design di platform to provide easy access to mortgage plans also pipo wey wan buy house go fit check dia eligibility and apply from anywhere in di world.

Dem say dis one-shop stop platform go reduce all di magomago wey dey associated wit buying houses plus di manual processes wey dey involved.

“Di portal dey reliable, secure and transparent and e get key features and benefits wey go best meet di demands of Nigerians wey dey di kontri and abroad”. Oga Daginwa tok.

Dis no be di first time wey government go set up policy to tackle housing problem for di kontri.

From di time of independence till now, various administrations wey don rule for di kontri don set up different housing programmes wit di aim to ensure say majority of dia citizens get roof ova dia head, but di problem still remain.

What to know about Bola Tinubu renewed hope housing project

Di Renewed Hope Cities and Estates Programme wey President Bola Tinubu administration start, dey hope to close di housing gap and to enable average Nigerians fit become home owners.

Dem officially launch di programme for February 2024, wit construction of 3,112-unit of Renewed Hope City for Karsana, Abuja, di kontri capital.

For May, di Ministry of Housing and Urban development say dem don begin di construction of 250 Renewed Hope Estate for Katsina state and anoda 500 housing project for Kano state.

Di minister for housing say dem don award di construction of di estates for 12 locations and for three cities across di kontri.

Di states wey di estates dey include; Yobe, Gombe, Ebonyi, Abia, Nasarawa, Benue, Akwa Ibom, Delta, Katsina, Sokoto and Oyo states. While di cities under di housing project dey for Lagos, Kano and Abuja.

Dem fund di houses for Abuja under (Public, Private , Partnership (PPP arrangement). Di one for Kano dey funded wit (ministry budgetary provision), while di one for Lagos state na through di (Federal Mortgage Bank of Nigeria and PPP).

How di online portal take dey work

Di first step pipo wey wan subscribe to dis housing project na to first sign up or create account on di renewed hope housing delivery portal website.

Next na to find di property dem like. Dis suppose match dia location, di price and di type of house dem want.

Opportunity dey for subscribers to check di house fotos, review am, look di descriptions and specifications to dey double sure.

Also different payment options dey. Subscribers fit pay through support from NHF loans, Rent to On Instalment and commercial mortgages.

Subscribers fit also access di release of 25% from dia Retirement Savings Account through di Pension Fund Administrators.

From di online protal, home buyers fit monitor dia application progress and how dia property dey develop.

Source