Detention of two Binance executives by Nigeria goment – wetin we know, plenty tok about Binance p2p

Di goment of Nigeria don detain executives of di world biggest crypto-currency Exchange Company, Binance.

Dem detain di executives ova allegations say dem dey ‘fix di kontri exchange rate’.

Na two Binance executives dem gbab but full details of wetin go happun to dem neva dey clear.

However, tori be say di two executives of di Binance company arrive Nigeria to come discuss di suspension of di trading platform wit di goment of Nigeria.

But tins no go well as di authority for Nigeria allege say dem dey tamper wit di exchange rate wey dey affect di economy of Nigeria.

Di govnor of di Central Bank of Nigeria Olayemi Cardoso bin tok on Tuesday say about $26 billion bin pass through Binance Nigeria in cryptocurrency trades.

Di CBN govnor tok say many of di trades for cryptocurrency na through “sources and users wey we no fit adequately identify”.

Bayo Onanuga wey be tok-tok pesin for to di president bin accuse crypto platforms say na dem dey fix di exchange rate for di kontri and dey cause di fall of di naira against di dollar.

Dis tori of di Binance executives na di latest move by di goment to clampdown on di crypto platform.

Di goment believe say di measure go save di naira wey don dey fall by almost 70% in di last eight months.

For 2021, young Nigerians for social media para afta di former CBN govnor Godwin Emefiele say dem no go eva accept cryptocurrency.

Oga Emefiele say cryptocurrency no be sometin dem go fit to monitor, so therefore dem no fit allow am to becme moni for di kontri.

Emefiele tok during one of im appearance for di National Assembly say, di cryptocurrency issue wey unite us today “na internet moni wey most pipo wey dey deal wit am no sabi anytin about am”

Dat time wen Emefiele tok say dem no go dey accept cryptocurrency again, plenty pipo bin para ontop social media.

Why Binance p2p no dey work for Nigeria

Binance P2P na anoda gbege wey analyst say e dey affect di Nigeria economy.

P2P na peer-to-peer method of transaction wey dey happun for Binance between merchants wey dey buy and sell for di platform wey third party no go dey involved.

Di way P2P work be say dem go fit sell di USDT for di exchange rate wey dey above di parallel market price for Nigeria.

Na wetin make di nigerian goment begin dey shook eyes for Binance P2P wey authorities tok say na major factor wey dey cause di fall of di naira sake of di actitivities wey dey happun for di platform.

Di federal goment bin first disable di website of Binance and oda cryptocurrency companies as dem begin dia clapdown on several bitcoin trading sites.

Now, Binance wey be di leading company for di crypto world don disable di P2P feature ontop dia platform.

Dis na sake of di clampdown wey di Nigerian goment don launch against di crypto company and users for Nigeria no go fit transact between diasef.

Source