Nigeria President Tinubu appoint son-in-law to run housing agency

Nigerian President Bola Ahmed Tinubu

Reuters
Dis na di first time President Bola Tinubu go appoint a relative to im goment since e take ova power last year May

Nigeria President Bola Tinubu don appoint im son-in-law as di head of di Federal Housing Authority (FHA), wey dey spark concerns about nepotism.

Oyetunde Oladimeji Ojo dey married to Oga Tinubu eldest daughter, Folashade.

Dis na di first time President Tinubu don select relative for position for di federal goment.

Announcing im appointment, di presidency say Mr Ojo get “over a decade of work experience for di housing and hospitality industries”.

According to one statement wey di Special Adviser to di President on Media and Publicity Ajuri Ngelale issue, expectations from Oga Ojo dey high pass oda appointees dem make.

“In view of President Bola Tinubu historic approval of di establishment of Building Materials Hubs across all six of di nation geo-political zones; financing and establishment of a National Social Housing Fund for low income and vulnerable groups and land reforms to collaboratively streamline access to land across all states plus unlock nearly $300 billion of dead capital for di sector, expectations dey high on am to hit di ground running in di delivery of affordable housing for millions of Nigerians in need, while providing millions of new job opportunities for Nigeria talented youths wey presently dey find work.”

Strong reactions dey go on for social media sake of di appointment, as some argue say more qualified and deserving candidates dey ground wey pass Mr Ojo.

“Blatant nepotism na leadership weakness. E dey unfortunate say Nigeran leaders no see am as a form of ethical failure,” one person post on X.

Some don come out to defend di presidency on di appointment, dem say im relationship wit di president no suppose stop am from getting goment jobs.

Im appointment dey part of di president move to overhaul di management of di housing ministry.

Di FHA, wey fall under di ministry, suppose dey help deliver affordable homes across Nigeria.

Di goment no immediately comment on di criticisms pipo dey raise on top di appointment.

Profile of Oyetunji Ojo

According to local media, Oyetunji Ojo na former member of di House of Representatives.

E bin represent di Ijero/Efon/Ekiti West constituency for Ekiti State between 2011 and 2015.

Dem born am on 26 December 1979 and na former House Committee chairman on communication.

According to former tori wey bin dey for di National Assembly website, Oyetunji attend Senton Secondary School between 1988 and 1994, e also get im Diploma in Journalism between 1988 and 1994.

Reports claim say e get Bachelor of Arts in Politics from di University of Greenwich, United Kingdom between 2002 and 2005.

Im also be businessman and active politician wey bin don get scandal of forgery sake of im educational qualifications.

Source