Top clubs for European leagues wey go suffer as dia players prepare to leave for di 2023 Afcon

United go miss dia first choice keeper Andre Onana.

Getty Images
L-R: Osimhen (Nigeria), Salah (Egypt), Onana (Cameroon), Partey (Ghana)

At least forty players for di English premier league go fit leave dia clubs for January to play for dia kontris at di 2023 Africa Cup of Nations for Ivory Coast.

Di Premier League dey predict say dis players wey don dey represent 13 kontris go dey absent from 13 January to 11 February 2024.

“For di last tournament for Cameroon for 2021, 34 players feature for 12 kontris,” di premier league tok.

Di number go fit increase dis year, but no be all di clubs go feel di impact.

Manchester United – Di club go fit loose Andre Onana (Cameroon), and Sofyan Amrabat (Morocco).

United go miss dia first choice keeper Andre Onana. Di Cameroon international don start 17 games wit 6 clean sheets.

Im also don chop bashing from fans and sabi pesin ova some of di mistakes im do wey cost Manchester United dis season. Despite dis, Onana make 66 saves.

But United and Cameroon Football Federation (Fecafoot) reach agreement say Onana go dey available for di Premier League game against Tottenham on 14 January, 24 hours before Cameroon start dia Africa cup of Nations against Guinea.

Di compromise wey di two sides reach go allow Onana to dey involved for di FA Cup third round tie at Wigan on Monday and Spurs visit to Old Trafford before flying immediately afta dat game to Ivory Coast.

Di oda player wey di team go miss be Sofyan Amrabat. Amrabat don play 10 games for premiership so far.

Even though Hannibal Mejbri no feature for many games dis season, im coach tok say im get plans give di 20 year-old.

For Tunisia, di midfielder play 27 games since im debut for 2021.

Westham United – Mohammed Kudus (Ghana), and Nayef Aguerd (Morocco).

Di new poster boy for di hammers Mohamed Kudus don score nine goals since im join di club (5 for di league, 4 for oda competitions).

Di 23 year-old Ghanaian feature for 14 premier league games.

For Ghana, Kudus get 30 caps wit 9 goals wey im go be di star man for di Black Stars.

Morroco defender Nayef Aguerd be anoda key pesin for Westham.

“We get Mo Kudus, Saïd Benrahma and Nayef wey we go lose for Afcon. E don dey disappointing but we for find a way to manage,” Moyes tok.

Liverpool – Mohammed Salah (Egypt)

Di Egyptian forward be Liverpool dia key man.

Mo don start all 17 league games dis season wit 11 goals and 8 assists.

Im all round performance put Liverpool for second spot for di league.

Tottenham Hotspurs – Pape Sarr (Senegal), Yves Bissouma (Mali)

Wit Senegal as one of di favourites for di Afcon, Pape Sarr go fit dey absent for spurs for di whole one month wey di tournament go happun.

Pape na 21 years but im already get 18 caps for di defending Afcon champions, Senegal.

Di midfielder start 13 of Tottenham games dis season wit 2 substitute appearances.

Yves Bissouma also don start 15 out of 17 Premier League games for spurs.

Di defensive midfielder be key pesin for di spurs team wey don dey challenge for di league.

Arsenal – Mohammed El Neny (Egypt).

Mohammed El Neny no dey get playing time for Arsenal.

So far di Egyptian midfielder only get one substitute appearance for di league but for kontri, im be key player wit 97 caps and 8 goals.

Crystal Palace – Jordan Ayew (Ghana)

Jordan Ayew na ogbonge player for Palace.

Di forward don play 16 of di 17 league games dis season wit one goal and three assists.

Im coach, Roy Hudgson tok say di Ghana player na “one of di most reliable and consistent players” dem get for Palace.

“You fit rely on am to give 100 percent for attack and defense,” di coach tok.

Everton – Iddrisa Gueye (Senegal)

Senegal midfielder Iddrisa Gueye bin one of Sam Dyche im regular starters.

Im play 13 league games wit one goal.

Some Nigerians players go also leave dia club for Afcon

Getty Images
AFCON 2023

Nigerian players wey go leave dia club for Afcon

Victor Osimhen

No doubt current Serie A champions FC Napoli go miss di current African player of di year wen e leave to represent Nigeria few days from now.

Osimhen wey top di Serie A goal scoring chart last year retain im position as one of di most important players for di Italian league as e currently dey on 8 goals and two assists dis season too.

For Napoli, di absence of Osimhen go be a big miss for dem.

Victor Boniface

Dis na anoda important player wey go be a huge miss for im team considering say im be one of dia best players dis season.

Witout Boniface goals and assist, Bayer Leverkusen for no dey top of di table for German Bundesliga at di moment.

E get 9 goals and 7 assists for league and anoda 4 goals and 1 assist for Europa wey make am valuable player to im German club.

Umar Sadiq

Even though e spend major part of dis season on injury im return to form show say Sadiq na huge player for Real Sociedad.

Di club wey qualify for Uefa Champions League round of 16 na team wey bin dey expect di return of di lanky Nigerian player from injury to move up di league table.

And as soon as e return e score two wonderful goals to help im team for La Liga wey further prove im importance to di team.

Sadiq dey among players wey Nigeria select for Afcon and im club go miss am.

Samuel Chukwueze

Di goal e score for AC Milan against Newcastle to send im team to Europa League show how important dis Nigerian player dey for im team.

Di former Villareal player na one of di players wey Milan manager Stefano Pioli dey rely on to help change game wen di need arise.

As Milan dey third for league dem go miss one of di players wey dem feel say go dey help dem push for di Serie A title or Champions League qualification.

Source