Student shoot fellow students on di first day of school resumption afta holiday break, take im own life

One couple lit candles for di vigil

Reuters
One couple lit candles for di vigil

One student don shoot six pipo for one high school for di US state of Iowa on di first day di school resume back from di holiday.

Police wey confam di incident tok say one of di student dey for serious condition and di shooter kill imsef.

Investigators see “pretty rudimentary” improvised explosive device for Perry High School, police tok.

Five of di pipo e shoot na students and one of dem na school administrator.

Di student wey die dey for di sixth-grade, wey be di class for 11 or 12-year-olds.

Reports of an active shooter bin enta for around 07:37 local time (13:37 GMT) and di first officer reach di scene within minutes, police tok.

Speaking to reporters afta di shooting, Iowa Division of Criminal Investigation Assistant Director Mitch Mortvedt tok say di officers wey rush to di scene quickly see who dem reason say be di suspect wit one self-inflicted gunshot wound.

Iowa police chief dey overwhelmed by school shooting
The British Broadcasting Corporation

Members of di community gada for Wiese park, dem hold candles to do vigil for di victims on Thursday evening.

Police later identify di suspect as Dylan Butler, one 17-year-old student. E dey armed wit one pump-action shotgun and one small calibre-handgun.

Oga Mortvedt also tok say di suspect bin “don post some tins on top social media in and around di time of di shooting”.

One of di pipo wey injure dey for critical condition and four odas dey for stable condition, Oga Mortvedt add.

Earlier in di day, Dallas County Sheriff Adam Infante bin tell tori pipo say sake of say di incident happun for morning, “luckily, na veri few students and faculty bin dey di building, wey I tink say no make di mata worse pass as e be”.

Lori Meinecke, one Perry High School teacher, bin tell one local radio station say she hear about six to seven gunshots around dat time.

Dem clear di middle at about 08:25 local time and dem clear di high school at 08:27 local time. Di two schools dey di same campus.

Perry High School shooting scene

Reuters
Perry High School shooting scene

One local TV station wey follow Kevin Shelley tok, parent of one 15-year-old, dem shoot im son for di hallway, but e go survive.

Mr Shelley son bin tell am say di gun hit am for back and e graze im arm before e run enta classroom to hide wit fellow students.

Agents from di Federal Bureau of Investigation (FBI) plus di Bureau of Alcohol, Tobacco, Firearms and Explosives (ATF) dey for di scene. Di Iowa Department of Criminal Investigation dey lead di investigation.

“Na horrible situation,” Linda Andorf, wey be di board president for di Perry Community School District tok, NBC report. “Dis just dey disgusting. E dey terrible.”

“E dey impossible to understand why anytin like dis go happun,” Iowa Govnor Kim Reynolds tok for one news conference, and add say “evri Iowan stand” wit di victims plus dia families.

According to di White House, US President Joe Biden don dey briefed on di shooting and e dey in touch wit Govnor Reynold office.

Di town of Perry get less dan 10,000 residents and e dey about 40 miles (64km) north-west of Iowa capital, Des Moines.

Di shooting dey come days before di Iowa caucuses start on 15 January, wey kick off di 2024 Republican primary process.

Di shooting dey come as one of di candidates, Republican Vivek Ramaswamy, dey scheduled to campaign for Perry. Dem don cancel di event and dem don replace am wit prayer and discussion between Mr Ramaswamy and local residents.

Source