Fotos from di burial of football legend Pele as e make im final journey home

Dem carri Pele coffin during im burial procession

Reuters

Late Brazilian football legend Pele don begin im final journey home as members of di military commot im coffin from Santos stadium to a private place wia dem go bury am.

Edson Arantes do Nascimento aka Pele procession happun for di streets of Santos, before di private family burial go take place.

BBC Frances Mao bin dey Santos as Brazilians gada to pay dia respects to Pele.

E dey very hot like oven for Santos about 30 degrees but e be like say na di whole city dey drawn to di heart of Vila Belmiro stadium, wia Pele coffin bin lie.

Brazil new President Lula da Silva also pay im respects shortly before di wake end.

Fotos of how di burial waka

Members of military carri Pele coffin from di Santos stadium

Reuters
Members of military carri Pele coffin from di Santos stadium
Crowd gada for streets as dem dey do procession wit Pele coffin

Reuters
Crowd gada for streets as dem dey do procession wit Pele coffin
Pele coffin wey dem cover in di Brazilian flag, comot Santos stadium ontop fire engine to begin di procession as thousands of mourners line up for di streets.

Reuters
Pele coffin wey dem cover in di Brazilian flag, comot Santos stadium ontop fire engine to begin di procession as thousands of mourners line up for di streets.
Brazil President Lula Da Silva for Pele funeral procession

Getty Images
Brazil President Lula Da Silva for Pele funeral procession
Pipo gada in front of di Santos stadium during Pele burial programme

Getty Images
Pipo gada in front of di Santos stadium during Pele burial programme
Pesin hold up number 10 jersey wit Pele name

Reuters
Pesin hold up number 10 jersey wit Pele name
Pesin dey cry during Pele funeral

Reuters
Pesin dey cry during Pele funeral
Pipo hold up signs wit Pele name during im funeral

Getty Images
Pipo hold up signs wit Pele name during im funeral
Crowd wey gada to attend Pele funeral procession

Reuters
Crowd wey gada to attend Pele funeral procession
Brazil president wit Pele wife

Getty Images
Brazil president wit Pele wife