Why Supreme Court troway UK goment plan to send asylum seekers go Rwanda

Pipo protest against UK deportation of asylum seekers go Rwanda

PA Media

Di Supreme Court don rule against UK government plan to send asylum seekers go Rwanda.

UK highest court rule say e dey unlawful.

UK goment bin tok say dia plan to deport asylum seekers go di east African kontri and ban dem from returning to UK dey important to stop illegal small boat crossing.

But di Supreme Court don rule say e dey possible say di Rwandan government go send pipo back go di kontri dem bin run comot from in di first place.

Di court say di policy go against human rights laws as e potentially leave di pipo dem send dia open to risk.

Dem bin ask UK most senior court to rule on one appeal wey di government file afta di Court of Appeal decide say di policy dey unlawful for June.

Di ruling na di latest stage for di legal battle on top di controversial plan since former UK Prime Minister Boris Johnson announce am for April 2022.

Dem cancel di flights wey bin wan airlift di refugees for June 2022 afta di Court of Appeal rule say di policy dey unlawful sake of lack of human rights safeguards.

Breakdown of di Supreme Court ruling

For inside one unanimous decision, di five Supreme Court justices agree wit di Court of Appeal say proper assessment no dey ground of weda Rwanda dey safe.

Di unanimous decision mean say di flagship policy no fit go forward for di current form.

“For di light of the evidence wey I don summarise, di Court of Appeal bin conclude say such grounds dey. We dey in agreement of di view say dem dey entitled to reach dat conclusion. Indeed, afta we don see di evidence ourselves, we agree wit dia conclusion.” Lord Reed tok.

Di judgment no ban sending migrants to anoda kontri, but e scata di £140m Rwanda scheme – and e neva dey clear which oda kontri dey prepared to sign a similar deal wit UK.

For dia judgement, di Supreme Court justices tok say “plenty facts dey grounds” to believe say Rwandan government fit send di pipo dem deport go di kontri go places wia dem no go dey safe.

‘We take issue wit dis ruling’

Minutes afta di ruling, di Rwanda government for inside statement tok say dem “takes issue” wit being defined as territory wey no be safe third kontri.

“However, we take issue wit di ruling wey tok say Rwanda no be safe third kontri for asylum seekers and refugees, in terms of refoulement. Rwanda and UK don dey work togeda to ensure di integration of relocated asylum seekers into Rwandan society.”

Di statement say Rwanda dey committed to dia international obligations, and dem dey recognised by di UNHCR and oda international institutions for dia exemplary treatment of refugees.

Rishi Sunak reaction to Supreme Court ruling

UK Prime Minister Rishi Sunak don also react to di Supreme court ruling.

For one statement, di PM tok say dis no be di outcome dem want and im government still “completely dey committed to stopping di boat.”

E add say di Supreme Court don “confam say di principle of sending illegal migrants to a safe third kontri for processing dey lawful” and dis “confam di government clear view from di outset”.

Source