Bank of Ghana explain wetin cause di $5.4b loss for 2022

Di bank of Ghana don tok say di plenti money wey loss for 2022 be sake of di kontri sabi di “peak of economic den social crisis”.

Press release from di bank say “debt distress, depreciation of di currency den inflation na im cause di wahala”.

Im also insist say di wahala start 2019 as di kontri revenue den expenditure no balance.

“Liquidity crisis don happun, wia di central bank intervene – na im loss $500m for reserves”.

As di kontri go di IMF, “di central bank don restructure di total goment debt”.

Di restructuring wia be di domestic debt exchange programme (DDEP) alone make di bank loss GHC 53.1b ($4.8b) of di GHC 60b ($5.4b) for di annual report.

Economic gurus den di opposition national democratic congress (NDC) dey put pressure make di govnor resign.

Dem give am twenty one days

But di bank don dey explain som of di expenditure dem make.

Di annual report show say dem spend GHC 97.4m ($8.7m) for foreign & domestic travels.

For 2021 dem spend GHC 28.2m ($2.5m). Na im di bank tok say “di exchange rate den inflation cause di jump”.

“Supervision staff don dey travel dey visit all dia regulated institutions den dia branches for di kontri,” di bank tok.

Di bank also tok say e take some of di moni don train personnel.

Dis na di reason di travel expenses don rise.

For di computer expenses – GHC 67.9 ($6.1m), di bank say “dem take replace desktop computers plus laptops den oda softwares”.

Dem tok say di hardware den software dem buy dey US dollars; im too, depreciation of di Ghana moni den inflation don affect am.

New bank office: Pipo don fire di bank ova dia new building dem dey take $250m build at a time wey di kontri dey economic crisis.

Di bank say di building be necessary sake of dia old structure don weak.

“Head office of di bank wey dem build 1960s no fit for purpose, wia eno sabi withstand earthquake,” di press release tok.

Na im di board den management figure say dem for build new one.

Di explanation solve di mata?

Despite say di bank don explain wetin happun, di opposition NDC insist say di govnors for resign.

Di minority leader for parliament Dr. Cassiel Ato Forson don tweet say “di bank im justification for di expenditure dey make dia mata worse”.

“Dr. Ernest Addison den in two deputies for dey responsible for mishandling di bank”.

Im also tok say “di bank disregard di kontri im laws sabi why #AddisonMustGo”.

One fellow for di center for democratic development (CDD), Professor Stephen Kwaku Asare don tok say di “bank of Ghana still get mata answer”.

Di governor of di bank of Ghana don dey under pressure over moni wey di bank lost last year.

Di bank make GHC 60b ($5.4b) loss for di 2022 financial year wia di annual financial statement don show.

Di governors go resign?

Before di opposition party go com tok say make di governor resign, oda pipo don tok am.

But head of research for di central bank Dr. Abradu-Otoo don tok say im no sure say di governor for resign ova di mata.

He say “internal den external issues don make di bank lose di moni – na im no be di fault of di governor.”

“Di bank go continue im work den fight inflation, den ensure stability,” Dr. Abradu-Otoo tok.