Apart from Speaker, who be Femi Gbajabiamila wey Tinubu appoint, wetin be chief of staff work

Femi Gbajabiamila, George Akume and  Ibrahim Hassan Hadejia

Collage
President Bola Tinubu make first appointments

Nigeria President Bola Ahmed Tinubu don appoint di Speaker of di House of Representatives, Femi Gbajabiamila as di Chief of Staff.

Di announcement of di appointment dey come days afta tori bin spread say Gbajabiamila don become di Chief of Staff to di president.

Gbajabiamila na di current speaker of di 10th House of Representatives – di green chamber wey dey expected to come to di end of dia tenure on 11 June.

Im na close padi of di president from way back – many see am as one of im protege.

However im appointment no go become effective until 14 June afta e finish im tenure as di Speaker of di House of Representatives.

Tinubu first appointments and wetin Law tok

Di president also announce di appointments of Sen. Ibrahim Hassan Hadejia, one former Deputy Govnor of Jigawa State, as Deputy Chief of Staff and former Govnor of Benue State wey also be di immediate past Minister of Special Duties, George Akume as Secretary to di Government of di Federation (SGF).

Di Nigeria leader announce di appointments during one meeting wit di govnors of di All Progressives Congress according to one statement wey di Director for Information, Abiodun Oladunjoye release on Friday.

Section 68(1) say ‘A member of di Senate or of di House of Representatives gatz leave im seat for di House of wey e be member if – e become President, Vice-President, govnor, deputy govnor or a Minister of di goment of di Federation or a Commissioner of di goment of a State or a Special Adviser.”

Now wey di president don appoint oga Gbajabiamila as Chief of Staff, e gatz resign from di House to make way for anoda lawmaker to take up di position until 11 June wen di life of di current House go end.

Wetin be di work of di Chief of Staff

Femi Gbajiamila and Bola Tinubu

@Femi Gbajabiamila
President Bola Ahmed appoint Speaker Femi Gbajabiamila as Chief of Staff

Di Chief of Staff (CoS) to di President of Nigeria na one high-ranking official wey im work na to manage di Office of di President.

Na former Nigeria President Olusegun Obasanjo bin create di position of di Chief of Staff for 1999 and e model am afta di White House Chief of Staff.

Di position of di Chief of Staff don become very important appointment sake of say pipo don begin attach importance to dat office.

Dis na becos anybody wey occupy di position get important role to play to make sure of di success or failure of di principal wey put am for dat position.

Na di president dey assign duties to di Chief of Staff but primarily im work dey focused on managing di flow of information and pipo; e dey advise di president on various issues.

To understand beta wetin di work of di Chief of Staff to di president entail, one tok-tok pesin to former President Muhammadu Buhari, Garba Shehu say di responsibility of di chief of staff na to maintain presidential relationship wit di oda two arms of goment, serve as di link between cabinet members and di president and also to supervise State House staff.

E say: “Di role and responsibilities of di Chief of Staff and di method of communication and arranging schedules between cabinet members and di president for Nigeria dey based on di US model, wia di same system dey operate – and how dem dey do am for many years – and di work na di same way.

Oga Shehu add say di role of di CoS include di following:

  • Serve as adviser to di president on any and all matters.
  • Line manager for all staff for Aso Rock.
  • Manage appointments and scheduling for di president
  • Garba say for traditional presidential system, na di primary function of a chief of staff, wey fit vary according to di needs and desires of each president, to supervise key State House staff, control access to di office and di person of di president and manage communications and information flow, wey fit include wetin bind di relationship wit di two oda arms of goment.

Femi Gbajabiamila Profile

Femi Gbajabiamila

Femi Gbajabiamila/Facebook
President Bola Tinubu appoint Femi Gbajabiamila as CoS

Olufemi Hakeem Gbajabiamila na di Speaker of Nigeria House of Representatives.

E be lawyer and politician wit over twenty years of active participation for di political life of Nigeria.

Dem born Gbajabiamila on di 25th of June 1962. E get im secondary education for Igbobi College, Yaba, Lagos and from dia e go King Williams College, Isle of Man, for UK for im Advanced Level. E study Law for di University of Lagos.

For 1998, e go back to school to study for Marshall Law School in Atlanta, Georgia for di United States of America.

Femi Gbajabiamila start im career as a lawyer wit di law firm of Bentley, Edu and Co., e comot afta some years to set up im practice, Femi Gbaja and Co.

Wen e come back Nigeria, Gbajabiamila enta into politics and e don dey elected for six consecutive terms to represent di pipo of Surulere 1 Federal Constituency of Lagos for di National Assembly.

E first dey elected to di House of Representatives for 2003 to represent Surulere 1 Federal Constituency.

E take part for active debates on di floor of the House and dis dey evident during di “third term debate” of former president Olusegun Obasanjo. E dey credited as one of di voices wey kill di “third term agenda” of di then President.

For 2007, e dey elected as Leader of im party, di Action Congress (AC) for di House of Representatives, and Minority Whip. By di end of im second term for office, Gbajabiamila don sponsor di highest number of Bills for di National Assembly.

During di administration of former President Musa Yar’Adua, wen e dey sick and dey absent for some time, e bring one motion to floor of di House and Senate wey lead to di swearing-in of Dr Goodluck Ebele Jonathan as Acting President.

For 2011, Femi Gbajabiamila dey nominated for di national award of Officer of di Federal Republic, (OFR) but e reject di nomination.

As a lawmaker, e don do many things to beta di lives of Nigerians apart from di bills like Students’ Loan (Access to Higher Education), Bill, 2019; Physically-Challenged (Empowerment) Bill, 2019; Criminalisation of Estimated Billing System Bill, 2019; Emergency Economic Stimulus Bill, 2020, and the Control of Infectious Diseases Bill, 2020, amongst odas wey e sponsor to improve di lives of Nigerians.

For October 2022, former President Muhammadu Buhari confer am wit national honour of di Commander of di Order of di Federal Republic (CFR).

Who be George Akume?

Senator George Akume

Senator George Akume
President Bola Tinubu don appoint Senator George Akume as SGF

George Akume wey serve as cabinet member for di immediate past administration of ex-President Muhammadu Buhari don come a long way wit di new president.

Dem born am on 27th December 1953. E come from Wannune Tarka Council Area of Benue State.

Oga Akume graduate wit Bachelor degree for Sociology and e get Master’s degree in Labour Relations from di University of Ibadan, Oyo State for 1978 and 1986 respectively.

Akume na one of di prominent Benue politicians wey don serve for di capacity of a govnor, senator and minister.

E bin contest under di Peoples Democratic Party (PDP) and emerge as di Governor of Benue State from May 1999 to May.

For 2019, e lose im senatorial seat to Senator Orke Jev of di Peoples Democratic Party (PDP).

Akume bin also dey elected under di defunct Action Congress of Nigeria (ACN) as di Senator wey dey represent Benue North West senatorial district.

E become di Minority Leader of di Senate from June 2011 to June 2015.

Former President Muhammadu Buhari appoint George Akume as Minister of Special Duties and Inter-governmental Affairs on 21 August 2019.