Dr Rahman Adedoyin: Timothy Adegoke murder suspect, Hilton Hotel owner sentenced to death

Osun State High Court wey dey siddon for Osogbo don sentence di owner of Hilton Hotel, Ife, Rahman Adedoyin to death by hanging for di murder of one OAU Masters student, Timothy Adegoke.

Di Chief Judge, Justice Oyebola Adepele-Ojo for her ruling on Tuesday find Adedoyin culpable of di offences of conspiracy and murder of di postgraduate student of the Obafemi Awolowo University, Ile-Ife.

Court discharge and acquitted three oda staff while di seventh defendant go hear her sentence on Wednesday following pleas by both di prosecution and defendant counsels.

Authority sama Adedoyin, im six workers, 18-count charge wey include murder, conspiracy, oath of secrecy among odas.

For her judgement, di Chief Judge on Tuesday discharge three defendants – Magdalene Chiefuna, Lawrence Oluwole and Adedeji Adesola -from di counts of conspiracy to murder and murder.

But dem find dem culpable of oda counts for di charge.

Court find Adedoyin culpable and convict am of counts 1, 2, 3, 7, 9, 15 and 16.

Dey also sentence di defendants to serve different years of jail terms for oda offences such as conspiracy and unlawful interference wit di deceased body for attempt to cover up.

Court room

BBC

Timothy Adegoke children education

Di Chief Judge, Adepele-Ojo hold say make dem forfeit di hotel wey belong to Adedoyin and di vehicle, (hilux van) wey di accused use kari di bodi of Adegoke to wia dem bury am, to di State.

Court also hold say di children of late Timothy Adegoke education dey placed under sponsorship of Abdulraman Adedoyin estate up to university level and completion of National Youths Service Corp.

Autopsy report get coma

Di Court hold say di second autopsy reports wey two pathologists from Obafemi Awolowo University Teaching Hospital sign dey thwarted.

Dem hold say “e be report by pesin wit vested interest”.

Di court establish say Timothy Adegoke lodge for Hilton hotel and pay into di account of di 7th defendant.

“I find di first defendant (Ramon Adedoyin) culpable of di conspiracy to murder and murder”, di judge tok.

Court also hold say di evidence wey dey presented bifo di court place Oyetunde Kazeem “squarely among those wey carry out di acts” and e find am guilty of di counts.

Di Seventh defendant (Adedeji Adesola) dey “carefully choreographed into di act. Di circumstance around her no dey strong to find her culpable of di count 1, 2, and 3” di judge add.

Di 1st, 3rd and 5th defendants get hand for di offence of conspiracy to improperly, indecently dump di deceased bodi and dey guilty as charged.

Wetin really happun

Tori be say dem declare Timothy Adegoke missing on Monday 7 November, 2021 before dem come find im dead bodi.

Adegoke, wey be Abuja-based student, bin travel to Ife on 5 November, to write one examination for di school distance learning centre for Moro, Osun State

Im family and friends begin worry wen dem no fit reach am and as e no show to write di exam.

Police find di deadi bodi of Timothy Adegoke, about one week afta dem declare say e dey miss

Police arrest Dr Rahman Adedoyin, owner of di hotel wia Adegoke bin lodge before e miss and six oda suspects ontop di mata.

Adedoyin, Magdalene Chiefuna, Adeniyi Aderogba, Oluwole Lawrence, Oyetunde Kazeem, Adebayo Kunle and Adedeji Adesola, dey stand trial over di death of Adegoke.

How di matta don waka

Afta di trial of allege murder of Timothy Adegoke start some months ago, different pipo including medical doctors don give dia witness account for court.

For di last sitting for April 2023, chief Judge of Osun State, Justice Adepele Ojo wey dey siddon on top di matter bin receive di final written and counter address from parties.

Counsels to di defendants, Yusuf Ali, Rowland Otaru, and Murtala Abdulrasheed, for separate applications, bin ask court to declare null and void di appearances, applications and oda legal activities of di prosecuting counsel, Femi Falana.

Dem say e allegedly lack locus standi to prosecute di matter.

Di defendant also tok say Falana no get fiat from di state Attorney General to prosecute di matter and say e fail to present any evidence of di fiat to di court.

But Oga Falana bin argue say e obtain fiat from di Attorney General and Commissioner of Justice of Osun State to prosecute di matter.

Key witness

One police Inspector Afeez Olaniyan – di third witness for di matter – during cross examination say afta dia investigation dem find out say late Timothy Adegoke bin actually lodge for Hilton Royal hotel, Ile-ife on 5 November, 2021.

Inspector Afeez Olaniyan -wey be di third witness for di matter – during cross examination say afta dia investigation dem find out say late Timothy Adegoke actually lodge for Hilton Royal hotel, Ile-ife on 5 November, 2021.

One consultant pathologist Waheed Oluogun, also tell court say dem find di bodi of Timothy Adegoke wey be MBA student for di Obafemi Awolowo University inside “bloody duvet for one dustbin site along Ile-Ife/Ede road near Obafemi Awolowo university”, afta bad pipo dump am dia.

Di doctor wey be one of di sabi pipo wey do Adegoke autopsy bin tok give Osun State High Court say na im and six oda pathologists do di autopsy, wey include Pro. E. A Afolayan, Prof. J. Obafunwa, Prof. O. S. Ojo, Dr. A. O. Komolafe, Dr. S. Sometimes, Dr. H. A. Akinyemi.

E say x-ray show fracture for di right thigh bone and clean cut wound wey just dey around di left side of Timothy chest.

E come reveal di cause of death as “severe bleeding sake of severe tromatic injury” .