Adamawa State Governorship election result 2023: INEC declare Adamawa State Governorship election wey involve Aisha Binani, Ahmadu Fintiri inconclusive

Independent National Electoral Commission don declare Adamawa State govnorship election inconclusive

Inec declare di election inconclusive sake of di margin of votes.

For di results wey dem announce All Progressives Congress candidate for di state, Senator Aishatu Dahiru alias Binani poll 390, 275

While di incumbent, Govnor Ahmadu Fintiri, the Peoples Democratic Party (PDP) candidate, poll 421,524.

So far di election joinbody don announce di results from 20 states

Na APC dey dey lead for 14 states, di PDP get five states and di New Nigeria Peoples Party (NNPP) get one state.

No be only Adamawa wey Inec declare results as Inconclusive, Kebbi too dey inconclusive

Meanwhile di collation of results of Abia and Enugu for Govnorship election dey suspended.

Move around di map to see di results local goment by local goment

Na here you go see di complete results of di 28 states wen Inec declare dem