Kaduna State Governorship election result 2023: Uba Sani win Kaduna state governorship election, defeating Mohammed Ashiru, Senator Othman Hunkuyi and odas

Govnorship candidates

BBC

Di Independent National Electoral Commission (Inec) don declare Uba Sani of di All Progressives Congress (APC) winner of di Kaduna state govnorship election.

Na Returning Officer for Kaduna State and Vice Chancellor of di Usman Dan Fodio University, Sokoto, Professor Lawal Suleiman Bilbis declare di result.

Sani poll 730,002 to beat im closest challenger Mohammed Ashiru of di Peoples Democratic Party (PDP) wey poll 719,196

Di Labour Party (LP) candidate, Jonathan Asake come third afta polling 58,285 votes while di New Nigeria Peoples Party (NNPP) candidate, Suleiman Hunkuyi score 21,405 votes.

Kaduna state governorship result

APC – 730,002

LP – 58,285

NNPP – 21405

PDP – 719,196

Move around di map to see di results local goment by local goment

Na here you go see di complete results of di 28 states wen Inec declare dem