Nnamdi Kanu court case: Federal High Court in Umuahia go deliver judgement on suit of extra-ordinary rendition of Ipob leader on October 27

"Nnamdi Kanu arrested today": [Ipob news] 'Nnamdi Kanu extradition arrest' in Nigeria ', go appear for Nigeria court - 'Abubakar Malami'

Getty Images
Nnamdi Kanu na im dey operate Radio Biafra

Di Federal High Court for Umuahia, Abia state don set October 27, 2022 as day dem go deliver judgement on di suit of di extra-ordinary rendition wey di leader of di proscribed group, di Independent People of Biafra, bring before am.

Di presiding judge Evelyn Ayandike adjourn di case afta she chook eye for di mata on Tuesday.

Kanu lawyers bin file di suit before di court for March dis year to redress wetin dem call di ‘infamous unlawful expulsion or extraordinary rendition of Nnamdi Kanu wey dem say na violation of im fundamental rights.

Kanu dey seek among odas make court give an order of injunction restraining and prohibiting di respondents from taking any further step in any criminal prosecution against am as well as an order to make di respondents pay di sum of twenty five billion naira to am as damages.

Nnamdi Kanu Lawyer Aloy Ejimakor for statement say di incident for Kenya na clear violation of im fundamental rights under Article 12(4) of di African Charter on Human and Pipos Rights, as well as Chapter IV of di Nigerian Constitution.

Di lawyer add for di statement say make “di Court redress di plenti violations wey come wit di rendition, like di torture, di unlawful detention and di denial of di right to fair hearing wey dey require by law bifo anybody fit dey expel from one kontri to di oda.

I dey also seek to stop im prosecution and restore am to di status quo bifo e dey rendition for 19th June, 2021,” e add.

Kanu Lawyer reply Malami over fresh accuse
The British Broadcasting Corporation

Wetin happun for court on Tuesday

Nnamdi Kanu lawyer ask di court to bring Kanu case from Abuja to Umuahia wia be im ancestral home.

Bar. Aloy also argue say medical report on Kanu health dey poor and say “because e need to dey alive to take im trial”.

Kanu counsel also argue say dem unlawfully extradite Kanu was from Kenya without duly filled application.

Meanwhile di defense counsel for di federal goment, Simon Enoch also make im argument during di proceedings before di adjournment.

During di court proceedings, Bar. Enoch argue say di application by Kanu lawyer na abuse to court process.

Di defense counsel argue say di applicant jump bail and need bin dey fro dem to bring am to law.

Around di court premises, armed Policemen wey dem draft in from di Crack Squad team of Nigeria Police to maintain law and order bin dey ground.

Di road wey bin lead to di court, Zone 9 Command and di State House of Assembly bin dey blocked as security for di area dey tight.

Counsel to Nnamdi Kanu and oda supporters for di court premises chant victory songs afta dem adjourn di case.

Ejimakor tell tori pipo say: “Di mata don finish but e neva finish kpatakpata, na for 27th October e go finish kpatakpata but e waka well since March dis year wey I file am.

E don waka sotay e reach one place wey goment lawyers tok say e go go Abuja, but I tok say e no dey go anywia na hia we go end am. Mazi Nnamdi Kanu from dis side, and di Federal High Court for Abuja no get power pass dis one, na di same dem be.

Di mata don waka sotay judge don hear di mata, na 27th October di judge go give judgement so we dey come back hia.” Na so e tok.

Federal High Court Umuahia

BBC

Wetin bin happun

Na for June, 2021 dem arrest Kanu, di leader of di banned Ipob.

Justice Minister Abubakar Malami for one press conference bin say dem return Kanu to Nigeria.

“We wan inform Nigerians say goment working with security agencies don succeed in attempt to arrest Nnamdi Kanu and we don bring am back come Nigeria Malami” bin tok

Malami bin tell tori pipo for Abuja, di kontri political capital, one afternoon of Tuesday 29 June 2021.

“Kanu go still ansa for di 11 charges wey e bin dey face for court before e try to escape justice and we don already re-present bifo court.”

Malami bin tok say Kanu arrest na through di efforts of Nigerian security agencies and Interpol.

Shortly afta Malami address tori pipo on Tuesday, one Nigerian court order di detention of Ipob leader Nnamdi Kanu

Federal High Court for Abuja later order say make dem detain Kanu for DSS facility.

Im case dey court.

How Nnamdi Kanu case don waka