Final funeral rites of late Ghanaian footballer, Christian Atsu happen today for de forecourt of de state house.
Govment of Ghana give Christian Atsu state funeral based on en contributions to football in de country.
- Ghana Christian Atsu na ‘one in a million’
- Body of late Ghanaian player Christian Atsu land for Kotoka International Airport
Family representatives, friends and football fans in Ghana and de rest of de world say dia last goodbye to de man wey people describe as humanitarian.

How de funeral happun
Dem lay de body of Christian Atsu in state so pesin wey want wish am farewell file past.
De Vice President of Ghana den oda key government functionaries be in attendance.

De President of Ghana dey in attendance.
Dem take de body to en village, Ada for burial.
Im widow Marie-Claire Rupio cry as she dey read one tribute.
“In life I love you darling, in death I go do di same,” Marie-Claire Rupio read.
Emotion overcome am and she hand di speech to Atsu sister to finish reading.
“You no go alone, sake of say part of me go wit you.
“Your smile, your love I see for our pikin smiles.”

How Christian Atsu die
On February 5, 2023 Christian Atsu score late winner for en team, Hatayspor in dia clash against Kasimpasa in round 23 of the 2022/23 Turkey Super Lig on Sunday.
He take to social media to share de exciting news to en fans about de late winning goal.
But de earthquake strike Monday dawn, that be de last tweet Atsu post and de last time anyone see am alive.

Im club Hatayspor bin initially report say dem rescue am “wit injuries” but one day later dat position change.
Atsu en agent, Nana Sechere den some family relations go de location to support in de rescue mission during which dem locate Atsu en room den some of en belongings.
Who be Christian Atsu

Atsu be Ghanaian international player who play professional football for Turkish Super Lig until he meet en untimely death inside earthquake.
Born 10 January 1992, de Ghanaian professional footballer play for Hatayspor since September 2022.
“Na wit de heaviest of hearts say I dey announce to all well wishers say sadly Christian Atsu’s body dey recovered dis morning” en Agent Nana Sechere tweet.
“My deepest condolences to en family and loved ones. I go like take dis opportunity tank everyone for dia prayers and support” he add.
De dead body of late Ghanaian footballer Christian Atsu don arrive in Ghana where, around February 19 wey se state receive en body.
Thousands of football fans and former teams share dia tributes to de late Ghana superstar who leave behind en wife and three kiddies.
More fotos from Christian Atsu funeral of how pipo bid am farewell


