England suffer painful loss to France for Qatar 2022 Fifa World Cup

England crash out of di Qatar World Cup

Getty Images

England World Cup campaign end for disappointment as dem comot despite dia fine performance for dia quarter-final against France for Al Bayt Stadium.

Harry Kane late penalty miss prove decisive afta e bin score di initial one to equal Wayne Rooney England record of 53 goals from di spot.

France take di 17th-minute lead wen Aurelien Tchouameni 25-yard drive beat Jordan Pickford.

England kontinu to show say na dem be di better side and create chances, until dem get penalty afta Tchouameni foul Bukayo Saka.

France regain di lead 12 minutes from time wen Olivier Giroud head in Antoine Griezman perfect cross.

England get anoda chance to draw level wen Theo Hernandez foul substitute Mason Mount inside di box.

Kane get di opportunity to make history but e lose am.

France don become di last kontri to qualify for di semi-final of di Qatar 2022 Fifa World Cup – dem go play Morocco for di second game while Croatia and Argentina go play di first game.

Second Half

England players dey try stop Mbappe

Getty Images

90+6mins: SUBSTITUTION. Jack Grealish enta for John Stones.

90+3mins: Raheem Sterling sends anoda long ball. Hugo Lloris save am again

90+2mins: Luke Shaw send cross into di box, but Hugo Lloris save am

90mins: 8 mins added time.

90mins: Mason Mount commit rough challenge

89mins: YELLOW CARD. Harry Maguire chop card for bad tackle

87mins: Olivier Giroud commit foul on im opponent

86mins: ref warn Jude Bellingham

85mins: SUBSTITUTION. Marcus Rashford enta for Phil Foden

83mins: Harry Kane fail lose di penalty

81mins: PENALTY APPEAL afta Mason Mount go down under a challenge from France defender.

80mins: SUBSTITUTION. Kingsley Coman enta for Ousmane Dembele

79mins: SUBSTITUTION. Raheem Sterling enat for Bukayo Saka. Mason Mount enta for Jordan Henderson

78mins: GOAL! Olivier Giroud make am two for France.

77mins: Olivier Giroud unmarked inside England box but Pickford save am.

76mins: Attendance for today match na 68895.

75mins: Ousmane Dembele whip di ball into di penalty area.

74mins: Jude Bellingham go down in di box after a challenge from di defender. Referee say nothing happun, play on.

73mins: OFFSIDE. Linesma catch Antoine Griezmann offside.

72mins: Ref Wilton Sampaio blow foul against Saka inside France 18

70mins: Harry Maguire jump high but im header lack accuracy.

69mins: Wilton Sampaio interrupt di game for tactical foul by Theo Hernandez.

65mins: Jude Bellingham pull di shirt of im opponent and di referee stops play for foul.

64mins: Jordan Henderson commit rough challenge and ref blow for foul.

62mins: Harry Kane receive low pass just outside di box and play fine strike towards di bottom right corner. Hugo Lloris save am again.

61mins: Ousmane Dembele receive good pass and from just outside di box e hit di ball but defender block am.

60mins: Good save by Hugo Lloris! Bukayo Saka go around di defenders and attempt to beat di keeper wit a close-range shot.

55mins: Adrien Rabiot almost make am 2 for France wit dat from long range without any delay. Pickford save am.

England 1-1 France

54mins: GOAL! Harry Kane convert di penalty

52mins: Ref blow penalty afta rough tackle by Aurelien Tchouameni on Bukayo Saka

52mins: Bukayo Saka produce dangerous cross into di box.

50mins: Antoine Griezmann take di free kick from a long way out but di defender manage clear am.

49mins: Bukayo Saka bring down im opponent. Ref blow for foul.

48mins: Jude Bellingham hit shot from far but Hugo Lloris save am go corner. Corner for England

48mins: Phil Foden take di corner, but one of di defenders react well.

47mins: YELLOW CARD. Ousmane Dembele chop card

England 0-1 France

45mins: Second Half don start

First Half

England 0-1 France

45+6mins: Ref blow for Half Time

45+4mins: Phil Foden take di corner but fail to find any of im teammates.

45+3mins: Olivier Giroud do im best to give pass, but e too long and go out of play.

45mins: Jude Bellingham deliver lovely cross into di penalty area. Opposition defender avert di danger wit a brilliant clearance.

43mins: YELLOW CARD. Antoine Griezmann chop card.

41mins: Ousmane Dembele manage to dispossess im opponent of di ball, but e commit a foul in di process.

41mins: Harry Kane create space for himself and attempt to put di ball into di box.

39mins: Wilton Sampaio blow for foul against Jordan Henderson.

38mins: Jordan Henderson do im best to handle di ball and give crossfield pass, but e dey too long and go out play.

37mins: Antoine Griezmann escape without any punishment from di referee afta e use excessive force to foul im opponent.

36mins: Antoine Griezmann go on a solo run, but e fail to create chance

34mins: Antoine Griezmann make aggressive challenge and ref Wilton Sampaio blow for a foul.

32mins: Adrien Rabiot get on di ball and beat an opponent, but England players stop di run

30mins: SAVE! Hugo Lloris save Harry Kane shot wey dey aim for goal

29mins: Bukayo Saka produce poor pass.

25mins: Harry Kane break into di box and fall afta a challenge from opposition player. NO penalty afta VAR check

22mins: Harry Kane receive great pass inside di box and miss a golden chance. The goalkeeper catch am.

20mins: Luke Shaw release promising shot from di free kick on di edge of di box. Hugo Lloris save am easily.

19mins: Adrien Rabiot foul opposition player

England 0-1 France

17mins: GOAL! Aurelien Tchouameni score for France

15mins: Kylian Mbappe attempt to send cross opposition defender

11mins: Jordan Pickford pull off a fine save! Olivier Giroud attempt to use head score afta correct cross into di box.

10mins: Antoine Griezmann run towards goal but di defender challenge am well. France get corner.

8mins: Harry Maguire play long ball across di pitch, but e miss di target.

6mins: Luke Shaw paly di free kick but France defenders block am.

5mins: Ref Wilton Sampaio no fit ignore di rough tackle by Ousmane Dembele.

4mins: Harry Kane produce a lovely ball into di penalty area but di defender manage to intercept and comfortably avert danger.

3mins: Some neat passing and movement from France as dem dey play di ball around

England 0-0 France

1min: KICK OFF

England vs France line ups

Top players for England and France

Getty Images

England: Pickford; Walker, Stones, Maguire, Shaw; Henderson, Rice, Bellingham; Saka, Kane, Foden

France XI: Lloris; Kounde, Varane, Upamecano, Hernandez; Tchouameni, Rabiot; Dembele

England vs France team news

Before di tournament, some pipo bin tink say France no go go far sake of di absence of some of dia key players, Paul Pogba, N’Golo Kante, and Karim Benzema.

But di defending champions don show why dem be champions wit Kylian Mbappe leading di goal scoring chart wit five goals.

Di Three Lions cruise pass Senegal for di round of 16 with a second-successive 3-0 victory after enduring a tricky opening 30 minutes.

England now rank as di youngest team for di World Cup wit an average starting age of under 27, but France also rank as the third-youngest. 

At just 19-years-old, Jude Bellingham na di only teenager to to don play plenty minutes, while Real Madrid midfielder Camavinga only turn 20 last month. Saka, William Saliba (both 21), Foden and Tchouameni (both 22) na di remaining under-22s.