How gunmen attack Senator Ifeanyi Ubah convoy, kill about five pipo for Anambra

Senator Ifeanyi Ubah

BBC

About five pipo don die afta gunmen attack di convoy of Senator Ifeanyi Ubah for Anambra state.

Di attack happun for Nkwo Enugwu-Ukwu, Njikoka Local Goment Area of di state.

Di senator aide, Kamen Ogbonna confam di incident to BBC Pidgin.

Viral video for social media show about three vehicles wit deadi bodi inside dem.

Ogbonna confam say di pipo wey die for di attack include di senator aides and police officers. But di senator wey bin dey inside bullet proof vehicle manage escape.

“Wen dem reach dat market for Enugwu-Ukwu, dem run enta ambush. Dem begin dey fire dem from front and back. Some gunmen even begin dey come out from di market itself.

Di driver manoeuvre im way out, den e dey able to escape. Dem fire several bullets on im own vehicle but e dey safe but some of my colleagues and police don dey confamed dead.” E tok.

Di aide express shock at di attack as di senator be friend to everybody so di incident shock dem.

“E dey surprising becos Ifeanyi Ubah na friend of everybody, so I no know wetin dis wan fit mean, I no fit say, we go allow security agents to do dia work and make we see wetin dem go come up wit.

Di aide also confam say since di senator travel for di latest trip di route wia dem ambush am na im regular road.

“Since e come back, e bin dey operate from Awka, since e come Anambra for dis trip, wetin e dey do be say wen e finish, e dey move from Awka wen e finish wit im engagement for di day e dey go back to Awka, so dat road na di route e bin don dey pass regularly for di last three-four days regularly without fail, so na either in di evening or in di night once e finish wit im engagement of di day, e dey move to Awka, so na regular route anybody wey wa target am go knolw for sure say e go pass dat place.” E tok.

Di aide add say di senator dey in a safe place.

Senator Ifeanyi Ubah speak on Anambra governorship election, Ipob and Nnamdi Kanu and
The British Broadcasting Corporation

Wetin police tok

According to local tori pipo, Police Public Relations Officer, DSP Tochukwu Ikenga, say di Commissioner of Police for Anambra State, Mr. Echeng Echeng, don already lead operatives to di scene for Nkwo market, Enugwukwu.

E add for statement say although details of incident no clear, operatives dey on ground dia to monitor di situation.

Di statement also say police dey committed to get to di root of di mata.

Reaction on Ifeanyi Ubah attack

One of Senator Ifeanyi Ubah vehicle wey di gunmen attack

BBC
One of Senator Ifeanyi Ubah vehicle wey di gunmen attack

Di attack on di Senator and former governorship candidate of Young People’s Party (YPP) for di 2021 govnorship election for Anambra state don attract reactions.

Wetin for be di fate of di Senator representing Anambra South if to say im no dey inside bulletproof vehicle? Dis na di question wey many pipo dey ask.

Charles Soludo, Anambra state govnor say goment dey determined to wipe out “everi act of criminality in di state.”

E say dis na di last time criminals go carry out attack for di state.”

One of Senator Ifeanyi Ubah vehicle wey di gunmen attack

BBC
One of Senator Ifeanyi Ubah vehicle wey di gunmen attack

Oga Soludo for statement wey Christian Aburime, im tok-tok pesin release on Monday say im don order security pipo to “fish out di perpetrators of dis heinous attack” and dem go face di law.

 “Di attack on di convoy of Senator Ifeanyi Ubah dey condemned,” Atiku Abubakar, presidential candidate of di Peoples Democratic Party tok.

Atiku for im social media post say need dey for security to return “to ensure dat safety and security return to our dear kontir.

Senator Uche Ekwunife, representing Anambra central for Nigeria National assembly also condemn di attack.

She say, “e dey unimaginable. My condolences go to Senator Ubah and di families of di police officers and oda aides of dey Senator wey wunjure and die for di attack. Dis no be Anambra of our dreams.”

Insecurity for di South East

Senator Ifeanyi Ubah wey dey represent Anambra South Senatorial Zone, na di Young Progressive Party candidate for di 2021 November Anambra state govnorship poll.

For exclusive interview e do wit BBC Pidgin den, Senator Ifeanyi Ubah bin call on south east govnors to take proactive approach and not to dey shy away for di mata of di insecurity for di region.

Di senator bin accuse govnors for south east say dem no dey do enough on di mata on insecurity for di state.

“Secure our state, no be to carry one point something billion naira monthly allocation, we no need more dan 200 million a month to secure Anambra state.

We wan secure di state, we wan chase away criminality, infact make I tell you, I wan accuse di govnors say na dem dey fund dis insecurity so dem go dey eat a lot of money, if not, to secure dis state na just one small little tin.” E bin tok.

Di senator tok bin come at a time di region record some high profile attacks and killings of pipo including security personnel.

Oda high profile attacks for di region recently

For May 2021, gunmen for Imo State assassinate Barrister Ahmed Gulak, wey be former political adviser to former Nigerian President Goodluck Jonathan.

Di Imo State Police Command bin confam to BBC say “bandits block Ahmed Gulak around Umueze Obiangwu for Ngor-Okpala Local Government Area”.Dem come shoot am dead wen im dey on im way to Owerri airport to catch flight to Abuja.

Meanwhile for September same year, Dr. Chike Akunyili husband to late Prof. Dora Akunyili die afta some unknown gunmen shoot am.

Di incident happun for Umuoji inside Idemili North Local Goment Area of Anambra State. Son of di late doctor bin tell BBC say Dr Akunyili bin dey return to Enugu from one meeting to honour e wife inside Onitsha wen di gunmen begin shoot im motor, kill am instantly with im driver and police orderly.