US religious freedom blacklist: America put Nigeria inside list

Nigeria presido Muhammadu Buhari for left, US Presido Donald Trump for right

Getty Images

Nigeria goment don deny di allegation say dem dey violate religious freedom.

Dis na as di US put Nigeria inside religious freedom blacklist wey be list of ‘kontries wey dey abuse religious freedom’.

Oda kontries for di blacklist na Burma, China, Eritrea, Iran, the DPRK, Pakistan, Saudi Arabia, Tajikistan, and Turkmenistan.

US Secretary of states Mike Pompeo wey announce am say dis na kontries of concern under di International Religious Freedom Act of 1998, im add say America dey committed to religious freedom and say no kontri or entity supposed dey allowed to persecute pipo anyhow becos of dia beliefs.

Pompeo no really tok di reasons why dem include Nigeria for di list but according to one yearly State Department report wey dem publish earlier dis year, dem bin note some areas of concern both for di federal and state levels.

Dis na some of di areas wey dem look:

  • Di report bin point to di mass detention of members of di Islamic Movement for Nigeria, one Shiite Muslim group wey don dey get kwanta wit goment for years now and dey banned by court.
  • Di State Department report bin torchlight di arrest of Muslims wey bin dey chop for outside for Kano State during Ramadan wen Muslims suppose dey fast.
  • Di report also torchlight di approval of one bill for Kaduna state to regulate religious preaching.

Wetin dis blacklist mean and how e fit affect Nigeria?

US explain say religious freedom na right wey nobody fit deny and na di koko wey dey make free societies grow.

Under US law, kontries wey dey di blacklist must improve or face sanctions. If Nigeria no improve, dem fit lose US goment assistance.

Wetin Nigeria tok?

Nigeria goment deny di allegation say dem dey violate religious freedom.

Inside statement by di Minister of Information Lai Mohammed, goment say di allegation na case of honest disagreement between di two nations on di cause of violence for Nigeria.

E say Nigeria dey jealously protect religious freedom as e dey inside di kontri constitution and dem dey take any violation seriously.

Di Minister explain say victims of insecurity and terrorism for di kontri be Christians, Muslims and oda religion.