Kidnapping in Nigeria: Senate pass bill, authorise life in prison for kidnappers

National Assembly

SHIRAZ CHAKERA

Nigeria Senate don pass Bill wey authorise di punishment of life in prison for any pesin wey dey guilty of kidnapping instead of di 10 years maximum sentence wey be e before.

Dis Bill amend law wey dey inside di kontri Criminal Code wey dey operate for di south of di kontri minus Lagos.

Di Senate also delete di law wey place limit on defilement plus remove gender restriction – now e no mata weda na man or woman commit di offence – on rape offence.

Na Senator Oluremi Tinubu sponsor dis Bill wey dem call “A Bill for an Act to amend di Criminal Code Act CAP. C.38, Laws of di Federal Republic of Nigeria 2004”.

If dis new Bill wey don pass third reading become law, e go mean say no more expiring date for victim of rape or sexual assault to report di case for di kontri.