Man, son and neighbour die inside pit latrine toilet tragedy for Kano state

Di phone accidentally fall inside di pit toilet

Getty Images
Di old man wan save im phone wey fall inside di pit toilet

Na very sad day for Sunday wia one man, im son and even neighbour bin fall inside pit latrine toilet for Kano state north west Nigeria.

Di sad incident bin comot tears and sorrow for di heart of pipo.

Wetin cause how di three pipo bin fall inside di pit toilet na phone.

Mallam Danjuma Bilack wey be 60-years-old bin dey di pit toilet wen im phone mistakenly fall for inside.

Na di phone wey accidentally fall inside di pit toilet make di old try comot am but unfortunately im come hook for di place.

According to di tok tok pesin for di Kano fire service Saminu Yusuf, wen di old man dey use im phone for toilet, di phone fall for inside by mistake. As im wan try enta di toilet to comot di phone, na dat time im hook for inside.

As di man dey struggle afta im fall inside di pit toilet, im son Ibrahim Danjuma wey be 35-year-old wan try save am. Di son also hook inside di pit toilet wit im papa.

Painfully, anoda neighbour wey dey di area bin offer to help di papa and son but instead make e save dem, im also hook inside.

“Im hook and den im 35-year old son Ibrahim Danjuma bin enta di toilet to help im father and dem both join bodi hook inside”.

“One resident of di area Aminu T Gaye bin also go to help di father and son but im also hook wit dem inside too,” di tok tok peson say.

By di time wey di rescue team bin get di emergency call, dem don die. Yusuf say wen dem bin bring di three men out of di pit toilet, dem dey unconscious and di hospital bin later confam say dem don die.

For 2018, authorities bin free six pickin wey trap inside pit latrine

Getty Images
Many kontris still dey use dis kain pit toilet for Africa

For Africa, different kontris still dey use pit toilet and many still dey practice open defecation sake of sake dem no get better toilet.

For 2018, authorities bin free six pikin wey trap inside pit toilet wey collapse for one primary school, Kisulisuli primary school for Kenya.

Source