11 Nigerians, eight Ghanaians don land Africa afta dem chop deportation from UK goment

Signpost

BBC

Some Nigerians wey UK goment deport don land Murtala Muhammed International airport Lagos early Thursday morning.

Our reporter meet at least 10 men among dem wen officials dey clear dem for di airport.

We no see any woman or pikin among dem. Dem carri small small luggage for ‘Ghana must go’ bag.

Some of dem wey speak to us behind camera say di matter na long tori for anoda day, say make dem cool down first den dem go yarn dia tori.

E never clear why UK goment deport each of dem, but documents wey we sight say show say dem get immigration palava for dia head.

For Ghana, sources tell BBC pidgin say eight Ghanaians naim land from di UK.

Seven out of dis pipo na men plus one woman

On Wednesday, Nigeria goment receive at least 131 stranded Nigerians from Libya.

Due to different reasons, plenti Nigeria dey try to relocate from di Africa most populous nation.

Why UK deport dem?

Nigeria Ministry of Foreign Affairs tell BBC say UK dey send di pipo back to Nigeria sake of Immigration related offenses. 

Some  of di deportees claim say dem don live for UK for many years. 

Some members of LGBTQ+ communities wey dey seek  asylum for UK follow for di pipo wey dem sendback. 

Dem fit face prosecution

Human rights campaigners UK say dem dey concerned about di welfare of di deportees.

Dem claim say about 10 women among di deportees dey suffer from severe mental health problems and dem dey on anti-psychotic medication. 

Campaigner believe some of di affected persons fit  face persecution – either becos of dia religion or on di basis of dia sexual orientation. 

On Wednesday Protestors gather for County Durham fornorth-east England to demand make dem all dem to kontinu to stay for Britain.