Tottenham vs Man United: Ronaldo and Cavani score to give United victory for Spurs

Cristiano Ronaldo.

Getty Images
Cristiano Ronaldo score di opening goal im first Premier League goal in almost six weeks, since United 2-1 win for West Ham

Manchester United bounce back from dia defeat to Liverpool last weekend to beat Tottenham for di Premier League.

Dem flog Spurs 3-0 for di Tottenham Hotspur Stadium on Saturday evening.

United goals come from Cristiano Ronaldo, Edison Cavani and Marcus Rashford.

Na Bruno Fernandes, Ronaldo and Nemanja Matic give di assists for di goals for di Red Devils.

Ole Gunnar Solskjær bin make some changes to di team wey lose to Liverpool afta fans bin dey call for di club to sack am

E bring in Cavani and drop Rashford for bench.

Dis na United first victory in five games.

Spurs bin dey vey poor for di match, di home team no even record a single shot on goal.

Dis result mean say Manchester United dey fifth position wit 17 points while Tottenham dey eight wit 15 points.

For United, dia next match na against Atalanta for Champions League on Tuesday while Spurs go play Vitesse for Europa Conference League.

Before di game BBC football expert bin torchlight di match and tok wetin im expect to happun including who im feel say go win.

Why fans go follow wetin happen dis match

“All eyes go dey on United afta dat 5-0 defeat and di question wey go dey pipo ask na if dem go change di way dem dey play?,” na wetin BBC football expert Mark Lawrenson tok.

“Di balance of dia team dey wrong at di moment, dat na di first thing. Di second one be say dem dey concede too many goals, so di koko against Spurs na to stop to do dat.”

Afta Man United constant poor performance, fans tok say dem don tire for coach Ole Gunnar Solskjær.

Tottenham vs Man Utd Lawro Prediction

Tottenham v Man Utd

BBC Sport

Solskjaer gatz make United difficult to beat.

Forget any flashy football for now, dem just need to start to dey more solid.

Wit di players United get, dem be counter-attacking team. Dem need to start to dey play like one, and soak up di pressure and play on di break.

Dis na tricky game to approach if you be manager wey dey under pressure like Solskjaer, but Tottenham still neva really settle like a proper too so I no go surprise me if United go dia and win.

Lawro prediction: 1-2