Christian Eriksen injury update: Denmark midfielder suffer cardiac arrest according to team doctor

Christian Eriksen

Getty Images
Eriksen require emergency treatment ontop pitch before dem take am to hospital

Christian Eriksen suffer cardiac arrest wen e collapse for Denmark Euro 2020 match against Finland, according to Danish team doctor Morten Boesen.

Earlier, officials say di midfielder bin dey stable for hospital and bin send im greetings to im national team-mates.

Eriksen collapse shortly before half-time for Denmark opening Euro 2020 game against Finland on Saturday.

“E bin don go. We do cardiac resuscitation, na cardiac arrest,” Boesen tok.

“How close we bin dey to losing am? I no know, but we get am back afta one defib [defibrillation] so dat one dey quite fast.

“Di examinations dem don do so far look fine. We no get explanation as to why e happen.”

Di 29-year-old Inter Milan player bin collect emergency medical treatment ontop pitch before dem take am go hospital.

Denmark fans bin dey upset as Eriksen receive treatment on di pitch

Getty Images
Fans bin dey upset as Eriksen bin dey receive treatment on di pitch

Saturday incident happen as dem play one throw-in towards Eriksen near di end of di first half.

Im team-mates surround am and di supporters wey dey in shock for Parken Stadium bin dey affected as di player bin dey collect treatment.

Boesen say Eriksen bin dey unconscious wen e reach di player ontop di pitch.

“Wen I reach wia e dey, e bin dey on im side, e bin dey breath, I still feel a pulse, but suddenly dat wan change and we start to give am CPR,” e tok.

“Di help come really fast from di medical team and di rest of di staff with dia co-operation, and we do wetin we got to do and manage to get Christian back.”

Na only once dem get info say Eriksen don wake up for hospital na im di players agree to resume di match. Finland win 1-0.

Denmark coach Kasper Hjulmand tell reporters afta di game say: “Na traumatic experience. We talk about di feelings and e for dey OK if to say dem say ‘no’ dem no wan play again.

“Some of dem no dey able to play, some ready. E no dey normal to play such a game wen one of your friends dey suffer with a heart issue.”

As di incident happun, Eriksen club and teammates bin send greetings.

Eriksen club, Inter, for tweet say: “Forza Chris, all of our thoughts dey wit you.”

Im former team, Tottenham say: “Get well soon, Christian. Di whole Spurs family dey wit you.”

Fellow Spurs player Son Heung-min also send message of support to im former team-mate afta e score di goal wey guarantee South Korea top spot for dia qualifying group for di 2022 World Cup.

Son score from di penalty spot against Lebanon before e run go one pitchside camera and hold up im fingers to signal 23, di shirt number di Dane wear during im time for Spurs.

“Christian Eriksen, I love you,” Son tok as e look into di camera.

Downing Street say British Prime Minister Boris Johnson dey “shocked” by wetin happun to Eriksen, and im thoughts dey with di Danish player and im family.

Last month, Eriksen help Inter clinch dia first Italian title for 11 years for im first full season with di club, afta e join from Spurs for £16.9m for January 2020.

Di Ajax youth player spend seven years with Tottenham, e score 69 goals in 305 appearances.