Sunday Igboho Oyo State: Igangan Fulani crisis, Ondo herdsmen quit notice latest

Sunday Igboho Oyo State: Igangan Fulani crisis, Ondo herdsmen quit notice latest

BBC
Southwest govnors for Nigeria don begin do meeting wit members of di Fulani communities for di Ondo state.

Di Igangan Fulani crisis plus Ondo ultimatum to herdsmen latest update be say Miyetti Allah, di umbrella join-bodi of Fulani herdsmen and Ondo state goment do meeting for Akure today.

All di six govnors of di states wey tanda for di Yoruba speaking southwest region of Nigeria [Oyo, Ondo, Lagos, Osun, Ogun and Ekiti] attend di meeting.

Tension dey increase for di Southwest states afta di deadline wey di govnor give herdsmen to pack comot from di region don expire.

Di meeting dey come days afta violence happun for Igboho, Oyo state.

Jigawa and kebbi from di northern parts of Nigeria wey be home to di Hausa/Fulani pipo dey also attend di meeting.

“Dis na una home, nobody dey send una away from dis state or any of di southwest states.”

Govnor Kayode Fayemi na im yan di on behalf of all southwest govnors to Fulani community for Akure on Monday.

[Akeredolu no order Fulani herdsmen to leave Ondo] – See wetin Govnor Fayemi and di oda govnors tok

Govnors and representatives of Fulani communities for southwest of Nigeria don resolve di farmers herders issues wey create tension for areas over di past few days.

For meeting on Monday for Ondo state, di govnors and Fulani reps agree to work together to make sure say security and peace reign for dia communities.

Govnor Kayode Fayemi wey speak for di govnors say gov of Ondo state no order Fulani pipo to vacate di state, say na media go pass wrong message.

“Wetin govnor Akeredolu tok be say make herders wey no dey registered comot from di forest reserves for Ondo to control unregistered herders wey dey cause trouble ” na so im tok

Dem decide say henceforth make herders no graze enter pipo farm lands again, no more night grazing and make dem no allow small pikin dem to dey graze animals.

Leader of Miyetti Allah Alhaji Baba Uthman say dem discover say some of di tins wey dey cause clashes na wen herders dey graze enter farmlands and some wey dey go grazing for night.

Di two groups agree say dem dey committed to one Nigeria and dem go support each other to make dis happen.

At di end of di meeting, both di govnor and di Fulani representatives look happy as dem greet each oda well and dey smile as dem dey go, unlike di kain tension wey dey ground wen di meeting bin wan start.

At di same time for Abuja, [Lai Mohammed] Nigeria Informationa and Culture Minister tell tori pipo say ‘Nigeria dey more secure now than ever before’.

“Di current security situation for Nigeria beta pass wetin di Buhari goment meet for ground for 2015 wen Boko Haram bin bomb 12 state including Abuja.” oga Lai Mohammed add.

Di Minister tok am during one interactive session of joint Press Conference on security wey him [Lai Mohammed] and di Interior Minister Rauf Aregbesola bin do on Monday afternoon for National Press Centre, Abuja.

“No politicise wetin dey happun for South West”, Lai Mohammed add.

[Igangan Fulani crisis, Ondo herdsmen quit notice] – See wetin de herdsmen rep tell di govnors

Fulani communities rep and MACBAN national secretary Baba Uthman say di clashes dey affect dem too as dem don witness some assassination of dia top leaders in some states like Kogi and Niger.

[Igangan Fulani crisis, Ondo herdsmen quit notice]

BBC

“Macban no dey support bad tin, we dey peaceful, democratic association, we dey work with security agencies to catch criminals.

We no happy wit wetin happun for Oyo wia pipo dey take laws into dia hands. We condemn all sort of criminality and extrajudicial killings.

We go continue to instruct our members to continue to work with goment to ensure good security and peace.

We dey instruct our members not to dey allow dia cows to enter pipo farm. Night grazing must stop henceforth. “

Make small children no go on grazing again…. dis na some of di tins Fulani communities rep identify say e follow dey cause all di clashes

[Fulani herdsmen] crisis background

Clashes between herdsmen and farmers dey cause plenti tension for some states of Nigeria over di years.

Di last clash lead to destruction of property and di killing of one Fulani leader for Oyo state.