Gas explosion for Rumuodumanya: Another gas plant for Rivers state don explode

Authorities don confam say three pipo injure for di gas explosion wey happun for Rivers state on Saturday.

E neva sure weda any pesin die yet, but dis second explosion dey come less dan 24 hours di first explosion kill four pipo and wunjure 11 for Delta state.

E happun for one gas plant off Airport road for Rumuodumanya, Obio Akpor local goment for Rivers State.

Di fire start around 8:43pm on Saturday 23 January 2021 night and wit di help of fire service and oda pipo wey dey live nearby, dem stop di fire around 10pm.

Meanwhile Rivers State Goment don seal up di gas plant wia di explosion happen.

Rivers State Commissioner for Energy and Natural Resources, Dr. Peter Medee wey visit di site of di gas explosion say from dia on di spot assessment, dem see say di company bin dey negligent for dia operations wey cause di fire and dat naim make am order di sealing up of di gas plant.

“We see some negligence for di operations of di company as dem bin dey discharge gas dat night wen one generator bin dey on, close to di direction and flow of di gas wey fit don cause spark wey don cause di fire.

We also see say di company get some safety gadgets in place but we no dey too satisfied say di safety gadgets dey operate well because we as ministry no dey aware of dis facility cos we for dey do our periodic audit of how effective dia safety standards and procedures dey.

Unfortunately dis tin don happen and I don direct make dem seal di place up while we conduct detailed investigation to find out wetin actually happen.”

Di Commissioner say di outcome of di investigation of all di relevant bodies both federal and State go determine dia next line of action

About three pesins get burn injury and dem dey take treatment for hospital. Most of di fire burn inside di premises of di gas plant and e no spread to oda properties as di community pipo help to fight di fire till e stop.