Sunday Igboho: How di popular Yoruba activist and im supporters show face for Igangan, Fulani community afta 7-day ultimatum

One popular Yoruba freedom fighter, Sunday Igboho, show face wit plenti supporters for Igangan town for Oyo State, south west of Nigeria just days afta im give fulani pipo seven days to leave di area.

Tori be say na today Friday January 22 be di deadline day wey im give Fulani pipo to leave di town.

Oga Igboho give dem di deadline dem when him confront di Seriki Fulani, Saliu Kadri afta im accuse dem say dem dey kill Yoruba pipo.

Him mention di killing of Oyo businessman, Fatai Aborode, Alhaja Serifat Adisa and her children, an Igangan prince, among odas.

Igangan na one community wey dey for Ibarapa North Local Government Area.

Oga Igboho claim say him dey act on di request of di traditional rulers.

Wetin we know so far

  • On January 15, popular Yoruba ”fighter” Sunday Igboho give di Fulani pipo wey dey Oyo state 7 days to comot di land wia dem dey stay.
  • Igboho dey accuse di Fulani pipo wey dey herd cow of killing and kidnapping for di state.
  • E warn say e go come chase dem away if dem no comot afta di 7-day ultimatum.
  • Oyo state govnor on Monday send delegation to Igangan village to meet wit di Fulani leaders ontop di mata afta dem report di ultimatum to am.
  • On Wednesday, Govnor Makinde for one television broadcast draw ear give anyone wey dey threaten di fulani pipo to stop or enta goment wahala.
  • Leader of di Fulani pipo for di state Seriki Fulani, Alhaji Abdulkadir tell BBC Yoruba sey dem no get anywia wey dem fit go. E say di misunderstanding go soon end.
  • On Friday January 22, Sunday Igboho enta Igangan Village wit plenti pipo as di 7 days ultimatum don end.
  • Seriki Fulani tell BBC Yoruba say some pipo don burn many vehicles down for im house
  • Igboho’s side say dem no even reach im side
  • When BBC contact di Police for Oyo state, di tok tok pesin Olugbenga Fadeyi say e go check im ”information”

Wetin Oyo state Govnor tok afta Igboho defile im order?

On Friday,Governor Seyi Makinde of Oyo State, say im no go allow anybody to hide under say dem dey protect Yoruba interest to cause ethnic katata for di state.

“For this administration, di koko for us na security, because we know say all di good economic plans no go dey possible if wahala dey.

Wetin di Fulani Leaders for di state tok?

Di leader of di Fulani pipo for di state Seriki Fulani, Alhaji Abdulkadir tell BBC Yoruba sey dem no get anywia wey dem fit go.

E say di misunderstanding go soon end.

Di Seriki Fulani also call on pipo make dem help dem beg Oga Igboho.

E tell BBC Yoruba on Friday morning say police don dey ground to maintain peace and order.

How Yoruba Socio-cultural Group , Afenifere take respond to Di Ultimatum?

Di Yoruba socio-cultural group , Afenifere condemn Sunday Ighoho quite notice to di Fulani pipo wey dey stay for Oyo state.

Oga Yinka Odumakin wey be di tok tok pesin for di group inside one interview wit BBC Yoruba say Igboho no get any right to give such order.

E say true true di kain thing wey dey happun for Oyo state no dey sweet belle , but dat one no mean say Oga Igboho fit do anything e want.

Oga Odumakin further tok say only Govnor Seyi Makinde fit give dat kain order, e come tell Igboho to match break and be patient, because di constitution no give am power to evict anoda pesin as imsef be ordinary citizen.