Doctors strike: Patients camp outside hospital as NARD begin strike for Nigeria

Plenti patients don hook for hospital on top dis strike

BBC
Plenti patients don hook for hospital on top dis strike

Some patients don camp outside Aminu Kano Hospital for Kano northwestern Nigeria as doctors begin nationwide strike for di kontri.

BBC Pidgin meet some of di patients wey say dem dey stranded as dem bin come see doctor s for di hospital.

Some patients wey speak tell BBC say dem don dey di hospital since 5am but na around 10.45am nurses come tell dem say doctors no go come say dem dey on strike.

Hajiya Basira Sani, one of di patients wey camp outside say:

“We be about 100 women wey wan see doctor, me I come around 5 am some come around 4am but na now(10.45am) nurses dey tell us say make we dey go house, doctors dey on strike, I no even get transport to carry me go house.”

Pipo dey stand up and down for hospital

BBC

Bashir Gidado come all di way from Katsina state for northwest Nigeria to see doctor for Aminu Kano hospital wey dey for neighbouring Kano state unfortunately doctors strike mean say e no fit see anybody.

Di man tell BBC say e no fit go back to Katsina state but go find wia to sleep until doctors resume to see am.

“I come run some tests last week and na today I suppose see doctor with di results but unfortunately dem start strike today, I come all di way from Katsina state and I no fit go back until doctors attend to me.”

“I don decide say I go beg for where to sleep until dem resume, even if na office I get I go dey sleep dia until doctors resume to attend to me.”

Abụbụọrụ

Getty Images

Amini Kano Hospital na di biggest for di state and chairmo of di resident doctors Dr Abubakar Nagoma tell BBC say na 500 of dem dey on strike for di hospital.

BBC Pidgin also visit di Rivers State University Teaching Hospital RSUTH see say dem never begin strike dia.

Chairman of di Association of Resident Doctors for Rivers State, Dr. Josephine Sokolo tell BBC Pidgin say, “na national strike. Dem call di strike yesterday so doctors no go rush leave dia patients like dat, dem get to inform dia patients first but na national strike na wetin I fit tell you now.”

Meanwhile for Abuja di nation capital, the resident doctors say more dan 200 hundred of dia members don dey infected by coronavirus, 10 don die and 800 pipo dey exposed.

Resident doctors dey give press conference

BBC
Resident doctors dey give press conference

Dr Aliyu Sokomba wey bi di oga kpata-kpata national association of resident doctors say di association decide to go strike sake of say goment no meet dia demand.

Di doctors bin ask goment make e provide dem wit enough personal protective equipment as di ones wey dey no reach; dem also want to reverse di illegal disengagement of 26 resident doctors for Jos

university teaching hospital and di payment of all dia salary in line wit di provisions of di medical residency training act.

Oda issues wey dem demand for na say make Kaduna state goment stop and refund all di illegal cut from salaries of dia members; implementation of di hazard allowance and payment of covid-19 allowance wey federal goment don agree.

For di letter, di doctors say e don tey wey dem don dey fight for equal right for all doctors wey dey the same level.

Oga Sokomba say sake of all these demand, dem bin give goment 14 days ultimatum to chook mouth for di mata and resolve di wahala but nothing really don happun.

And dat dis na why dem di call on doctors below di rank of Principal Medical Officer and House officers to begin strike from 12:01 am on Monday, 15th of June.