Human rights group tell Iran to release woman dem detain after she comot her cloth for univeristy

Parham Ghobadi

BBC News Persian

Screengrab of a video showing an Iranian woman sitting in her underwear at the Science and Research Branch of Islamic Azad University in Tehran, Iran

Telegram
A video showed the woman sitting in her underwear on steps at Islamic Azad University before walking down a nearby street

Human rights activists don call on di authorities for Iran to release one woman wey dem detain afta she remove her clothes for one University, for wetin dem protest against compulsory hijab laws.

Video bin comot for social media on Saturday wey show di woman as she wear her underwear and sidon and waka quietly along pavement for Science and Research Branch of Islamic Azad University in Tehran.

Di second video show wia di woman dey comot her underwear. Small time plainclothe agents show face and detain am, push am inside motor.

Azad University say di woman dey suffer from “mental disorder” and dem don carry am go psychiatric hospital.

Plenti Iranians for social media question di claim and tok say her actions na part of di “woman, life, freedom” movement wey don see plenti women push away di law wey force dem to cover dia hair and wear long, loose-fitting clothes.

Reports tok say more dan 500 pipo die during di nationwide protests wey start two years ago afta Kurdish woman Mahsa Amini die for police custody afta dem detain am sake of say she no wear hijab “properly”.

Dem say di woman hit di door of di plain clothes agents car wen dem detain am and e make make am bleed and dem carry am go undisclosed location.

Witness tell BBC Persian say di woman enta dia class for Azad University and begin feem students. Wen di lecturer tell am to stop, she comot and begin shout, na so dem tok.

According to eye witnesses di woman tell di students say “I don come to save you”.

Iranian media release video wey show one man wey dem blur im face say na im be di woman ex-husband and ask di public make dem no share di video sake of di woman two children. BBC Persi an never verify di man claims.

“Wen I bin protest against mandatory use of hijab, and security forces arrest me, dem preasure my family to declare me mentally ill,” na so Canada based women rights activists Azam Jangravi, wey bin run comot from Iran afta dem sentence am to three years in prison un to say she remove her headscarf during public protest for 2018.

“My family no gree do am, but plenti families dey do am, unto say dem think say na di best way to protect dia loved ones. Na so di Islamic Republic dey use discredit women by questioning dia mental health,” na so she tok.

Amnesty International say Iran “must immediately and unconditionally release di university student wey dem arrest violently”.

“Pending her release authorities must protect her from torture and oda ill-treatment and ensure access to her family and lawyer. Allegations of beating and sexual violence against her during her arrest nid independent and impartial investigations. Dem must hold pipo wey dey responsible to account,” na so e tok.

Di UN Special Rapporteur on Iran, Mai Sato, post for X say she go dey monitor di incident closely including di response of di authorities.

Narges Mohammadi, wey be Iranian Nobel Peace Prize laureate wey dey prison currently for Iran put out statement wia she tok say she dey gravely concerned about di case.

“Women dey pay di price for defiance, but we no dey bow down to force,” na so she tok

“Di student wey protest for di university turn her body – long weaponised as tool of repression – into symbol of dissent. I call for her freedom and an end to di harassment of women.”

Source