Nigeria Chief of Army Staff Lt Gen Taoreed Abiodun Lagbaja don die

Di president of Nigeria don announce di death of Chief of Army Staff, Lt Gen Taoreed Abiodun Lagbaja.

Chief of Army Staff, Lt General Lagbaja die for Lagos on Tuesday night.

Dis dey come afta president Bola Ahmed Tinubu announce di appointment of a new acting Chief of Army Staff (COAS).

Oga Tinubu appoint Major General Olufemi Olatubosun Oluyede as di acting COAS to takeova from Lt-Gen Taoreed Lagbaja wey neva appear for any public function for sometime now.

Di announcement of di death of Lagbaja na afta di presidency say e suffer illness wey take im life.

Late Chief of Army Staff Lagbaja die at di age of 56 afta spending one year and some months for di position.

For di statement released by Bayo Onanuga, di special adviser to di President Information and Strategy, Oga Tinubu praise di late Chief of Army Staff for im professional growth during im service.

“President Bola Ahmed Tinubu, Commander-in-Chief of di Armed Forces, regret to announce di passing of Lt. General Taoreed Abiodun Lagbaja, Chief of di Army Staff, for age 56,” di statement tok.

“E pass away for Tuesday night for Lagos afta a period of illness.”

Lt. General Lagbaja dey survived by im wife, Mariya, and dia two children.

Oga Tinubu send condolences to di family and di Nigerian Armed Forces sake of di death of dia boss and honour im ogbonge contributions to di nation.

“President Tinubu express im heartfelt condolences to di family and di Nigerian Armed Forces during dis difficult time.”

Tinubu also wish Lt. General Lagbaja ‘eternal peace.’

Dem born late Lt General Lagbaja for February 28, 1968, bifor Tinubu come appoint am as Chief of Army Staff for June 19, 2023.

Late Lt General Lagbaja begin im military career wen e enta di Nigerian Defence Academy for 1987.

For September 19, 1992, late Lt General Lagbaja dey commissioned as a Second Lieutenant for di Nigerian Infantry Corps as a member of di 39th Regular Course.

Throughout im service, late Lt General Lagbaja don demonstrate ogbonge leadership and commitment wen e serve as a platoon commander for di 93 Battalion and di 72 Special Forces Battalion.

Source