Shocking photos from Spain as floods kill more dan 200 pipo and more rains still dey expected

Cars piled high alongside rubble as a man walks through mud with a dog in Sedavi, Spain on 30 October 2024

Getty Images
Di flood pack vehicles on top each oda for Sedavi region

Emergency workers for Spain dey work around di clock to find pipo wey dey miss afta flash flooding wey happen between Tuesday and Wednesday don kill more dan 200 pipo so far.

But more rain dey expected to fall on Friday and Saturday in some places.

E neva dey clear how many pipo wey dey miss but goment don send hundreds of soldiers to di province of Valencia wey be one of di worst-hit areas, to help wit di rescue operation.

For some areas, di equivalent of one year rain na im fall for inside just few hours, and e cause massive floods wey sweep away towns and trap plenty pipo for inside dia house.

A man stands in front of rubble and cars in Valencia, Spain on 30 October 2024

Getty Images
Dis na one of di worst natural disasters for Spain history

For some places, na only helicopter fit go dia becos mud, debris and piles of cars don block di road. One BBC tori pesin say communities dey devastated.

Spain don declare three days of mourning for di pipo wey die.

A woman in distress hugs a man

EPA
A resident walks over debris in the flood-hit municipality of Paiporta, in the province of Valencia, Spain, on 30 October 2024

EPA
Debris scata across di streets of Paiporta, Valencia

High altitude depression: DANA

Di rainfall wey come wit strong winds and tornadoes na as a result of wetin sabi pipo for weather mata dey call DANA – Spanish acronym for high-altitude isolated depression.

E affect large areas for di south and east of Spain.

Reports dis Friday morning tok say di “Dana” weather system wey cause di flooding rainfall don dey weaken now, but more rain dey expected to fall on Friday and Saturday for some places.

Damaged cars are piled up along a road affected by torrential rains that caused flooding, on the outskirts of Valencia, Spain, on 31 October 2024

Reuters
E no dey possible to pass some major roads for Valencia

Rainfall warnings dey in place for areas wey dey north of Valencia – especially around Tarragona and Castellón regions, as well as Menorca and Mallorca. Also for south-west Andalucía around Huelva and Condado.

For dis regions, rainfall fit reach 100mm ova di next 12 hours. As di ground don already dey saturated wit water, e fit cause even more flooding.

But di rain suppose calm down by Saturday, and a much weather dey in di forecast across Spain by Sunday.

A street in Paiporta, Valencia, filled with mud on 30 October 2024

EPA
Pipo of di town of Paiporta dey survey di damage

Spanish Prime Minister Pedro Sanchez tok say flood victims “no go dey abandoned” and say dem go rebuild towns and cities wey di floods affect.

Di President of di European Parliament, Roberta Metsola, also express her solidarity wit all di pipo wey dey affected and she also tank di rescuers “wey dey do evritin possible to help pipo in need.”

Insurance analysts say di floods on Tuesday and Wednesday go be di costliest natural disaster ever to hit Spain, according to Spanish newspaper El País.

Relief workers on top tree branches in a street

Getty Images

One thousand relief workers don dey deployed to assist wit rescue operations.

Due to di heavy rains – di heaviest for almost one century – many pipo bin spend di night on top of dia cars as dem dey wait to dey rescued.

Di central goment say trains and flights dey severely affected as cancellations don plenty.

Also, about 150,000 pipo no get electricity sake of di disaster.

Wetin be di DANA phenomenon?

Map of Spain showing the province of Valencia and the city of Chiva

BBC

Di term DANA na wetin meteorologists for Spain start to dey use some decades ago to differentiate am from di more generic word “gota fría” (cold drop).

E dey usually refer to any situation of too much rainfall, especially wen e happen for di Mediterranean coast of di Iberian Peninsula during di autumn.

DANA na phenomenon wey be say mass of veri cold polar air dey isolated and begin to dey circulate at veri high altitudes (between 5,000 and 9,000 metres), far from di influence of atmospheric circulation.

Den wen e collide wit di warmer and more humid air for di Mediterranean Sea, e go generate strong storms – especially for di end of di northern summer and beginning of autumn, wen sea temperatures dey higher.

More photos of di devastating floods for Valencia, Spain

A car lies on top of a crash barrier while another car does the same on the other side of a flooded road

Getty Images
A car with its rear wheels high up against a wall and its front pointing into mud while a woman can be seen beneath its rear wheels as she walks towards the vehicle

Getty Images
Di Spanish goment say dis na one of di worst flooding for di kontri in di 21st century
Destroyed cars in a flooded ditch

Getty Images
Two men support a woman who appears to be upset

Reuters
Cars and debris on top of twisted railway tracks

EPA
Railway tracks for Valencia don block
A woman empties  muddy water into the street from a bucket

Getty Images
Residents don start to dey clean up dia homes
Cars piled up in a line as people walk past them

Getty Images
A man looks at a tree and wood beside three buildings

Reuters
A woman with a blanket around her while other people stand nearby

Getty Images
Goment don create temporary shelters for di worst hit areas
Men stand in a flooded street alongside someone in a high visibility jacket

Getty Images
A man stands on the bonnet of a car among other vehicles that are stacked up on one another

Getty Images
A car roof sticks up out of flood waters

Getty Images
Cars covered by tree branches in a street

Getty Images
Men in high visibility jackets in front of debris

Getty Images
Spanish authorities don deploy more dan 1,000 uniformed personnel to help for di rescue operations
Grey line

BBC

Source