Wetin happun as Verydarkblackman table Bobrisky, EFCC mata bifor National Assembly

Martins Vincent Otse wey pipo sabi as Verydarkblackman don present some evidence to di House of Representatives joint committee set up to probe di allegations of bribery against di Nigerian Correctional Service and Economic and Financial Crimes Commission officials.

On Monday, Verydarkblackman appear bifor di committee, wia im claim say Bobrisky wey im real name Idris Okuneye dey blackmail pesin wey allegedly borrow am money wit sexual allegations.

Verydarkblackman address di committee on Monday – e also submit im allege evidence.

E claim im share di audio on social media afta im listen to di audio and im see say some EFCC officials get hand for di mata.

“Na as result of Bobrisky blackmailing pesin wey im dey owe, based on di chat, e dey owe di pesin four million naira ($2,300). Di pesin give am loan and wen e reach to collect di loan back. Bobrisky refuse to return di money and begin dey blackmail am,” e tok.

“Na my friend send di evidence (receipt), Bobrisky begin beg di guy and pay but wen I listen to di audio. I keep di receipt of di audio.”

Verydarkblackman wey bin tok say im no go tok anytin if Bobrisky and EFCC chairman, Ola Olukoyede no appear bifor di probe panel by House of Representatives, later begin tok.

“I no see any reason why I go come here and Bobrisky no go dey here. My lawyer go tok. I no go tok anytin until Bobrisky and EFFC chairman come here. If I tok anytin, make I die,” e tok.

Deyi Adeyanju im lawyer also tok to tori pipo say im client go tok but im want make oda invitees appear bifor di panel.

Verydarkblackman ask di committee make dem investigate di mata and chook mouth into wetin im claim say na “Bobrisky godfather.”

However, di committee ask verydarkblackman make im address di panel on di viral audio wey im share ontop im Instagram page on 23 September.

Wen di panel call upon, Bobrisky, make im address di panel. Di Lawyer wey dey represent Bobrisky apologise for im client absence but wen dem ask wia Bobrisky dey e tok say “e no dey feel fine, e dey under di weather”

“Idris Okuneye dey absent becos of im illness” but di committee no allow am tok on behalf of im client as dem open di floor for oda invitees.

‘Bobrisky get some female features’ – NCoS

Deputy Controller of Corrections (DCC), In-Charge of Medium Security Custodial Centre (MSCC), Kiri-Kiri, Lagos State, Michael Benson tok say wen Bobrisky dey dia facility dem discover say im get female organs even though im be male.

“Though na male, e get some female features and dis na di original medical examination by di facility medical doctor,” e tok.

“Di admission board enta meeting to discuss di best practices and we arrive at di decision to put am in protective custody and e spend di10 days for our P ward room two of di facility.”

E explain say dem no fit lock am up like oda inmate na why dem classify im case as special case lock am somewia else.

“During admission, e get wetin we dey call classification of inmates. In im case, e dey peculiar and we gatz take peculiar steps,” e tok.

On September 23, Verydarkblackman for one video wey don circulate on social media bin play audio recording wey involve two pipo.

E claim say na Bobrisky and one pesin bin dey tok, claim wey BBC no fit confam.

For di audio recording, di voice wey Verydarkblackman say na Bobrisky own tell di oda pesin on di phone say im pay 15 million naira to unnamed EFCC officers to avoid prosecution for alleged money laundering.

Dis don cause many gbas-gbos ontop social media as Economic and Financial Crimes Commission (EFCC), Nigerian Correctional Service, Minister of Interior and Nigeria lawmakers don chook mouth for di matta to pin point wetin happun.

On 4 April EFCC confam say Bobrisky dey dia custody and e go appear bifor di court on 5 April, wit six-count charges against am by di commission.

For 12 April 2024, court bin sentence Bobrisky to six months in prison for naira abuse afta im plead guilty to di crime.

On 5 August, Bobrisky comot for prison afta im six months jail term wey begin count from 24 March, 2024 di day wey EFCC first put am for detention.

In 23 September, Verydarkblackman bin share one viral recording, wey im allegedly claim say e belong to Bobrisky.

Minister for interior, Olubunmi Tunji-Ojo tok also chook mouth say di service go investigate di matta and dem no go spare any official wey dey involve in di matta

Falz wey pipo sabi as Folarin Falana tok say im give Verydarkblackman 24hours make im delete im viral videos ova allegatons of “homosexuality” and di involvement im papa, Femi Falana (SAN), wey Verydarkblackman allege say im dey involve in di bribery of goment officials.

On 26, Nigerian Correctional Service, (NCoS) suspend two senior officers of di Service in relation to Bobrisky mata to investigate di officers wey be senior officers of di maximum and minimum security custodial centres for Kirikiri, Lagos State, southwest Nigeria.

On 26 September, di house of representatives tok say dem go probe di bribery allegations against di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) and di Nigerian Correctional Service (NCoS) during plenary on Monday.

On 30 September, VeryDarkBlackMan appear bifor di probe panel set up by di committee.

Source