UK go deport Nigerian Masters student wey make terror threats against im university afta e go jail

One Nigerian Masters student wey go make terrorist threat against Dundee University don chop 40 months jail sentence.

Somtochukwu Okwuoha claim say Isis go help am bomb di university and tell di staff im plan to target di city for chemical attack.

Di court order immediate deportation for di international energy studies student afta im release from prison.

Di 26-year-old dey guilty of seven charges by jury for July.

Sheriff William Wood tell am: “Your presence for United Kingdom no dey conducive to di public good, and I don make recommendation for your deportation in due course.”

Di court bin hear say Okwuoha enta UK for 2021 and form a friendship wit anoda fellow student, wey no gree date am.

Sheriff Wood say: “You dey abusive toward am and try so dem go remove her from her university course.

“Di university decide to suspend you from your course and you turn your attention towards staff.

“You threaten mass murder, terrorism, you tok say, you go plant bombs and use biological weapons.”

‘Blood go spill’

Witness describe how Okwuoha claim say im get military background and im dey capable of making bombs and unleashing a deadly virus on di city.

Keith Mackle, 58, now retired director of student services, tell Perth Sheriff Court say e dey aware of “serious concerns” for di autumn of 2021.

Im say staff members receive emails making terrorist threats.

One say: “Expect massive bomb explosion for University of Dundee. I don contact Isis terrorists to plant bombs on campus.

“I fit assure you say staff and students go die in great numbers. 9/11 no be joke compare to wetin go happen.

“Blood go spill and flesh go scata.”

Accommodation officer Shane Taylor tell di court, Okwuoha accuse am of being racist and say im plan to wipe out Scottish pipo as revenge.

Okwuoha, one prisoner for Perth, dey guilty of threatening to murder staff at di university and commit terrorist crime between December 2021 and June 2022.

E dey guilty of threatening to commit mass murder, using biological weapons, showing staff details to international authorities, and claiming to plant bombs.

E also dey guilty of threat to cut police officers head and detonate bombs wey im don plant for Dundee University.

Source