Who be di new Directors-General of Nigeria intelligent agencies – NIA and DSS

President Bola Tinubu don approve di appointment of new Directors- General for di National Intelligence Agency (NIA) and di Department of State Services (DSS).

Di Nigerian leader appoint Ambassador Mohammed Mohammed as di new Director-General of di NIA.

And oga Adeola Oluwatosin Ajayi na di new Director-General of the DSS.

Special adviser to di President on Media and Publicity, Ajuri Ngelale announce di appointment inside statement on Monday.

Di new appointments dey come afta di resignation of di previous NIA and DSS chiefs.

Oga Ajayi go replace Yusuf Magaji Bichi wey former President Muhammadu Buhari appoint for 2018, while ambassador Mohammed Mohammed go replace Ahmed Rufai.

Di former Director General of di National Intelligence Agency Ahmed Abubakar bin go di Presidential Villa on Saturday wia e submit im resignation letter.

E submit im letter of resignation afta e get small meeting wit President Bola Tinubu wia e brief am about issues of National Intelligence.

Di former NIA boss Abubakar tell tori pipo on Saturday afta im meeting wit President Bola Tinubu say, im discuss wit Tinubu wey understand wit am.

Abubakar tok say im come to visit Tinubu to “brief Mr President on issues and today no dey different.”

But tori of di resignation of di former DSS oga Yusuf Magaji Bichi no come out.

Who be Ambassador Muhammed Muhammed

Muhammed get ogbonge career for di foreign service since e join di NIA for 1995.

E don serve for various roles, wey add to im promotion to di rank of Director and im subsequent appointment as di head of di Nigerian mission go Libya.

Di 1990 graduate of Bayero University, Kano, bin serve for North Korea, Pakistan, Sudan, and for di State House, Abuja.

Who be Adeola Ajayi

Di new DSS Director-General, Adeola Oluwatosin Ajayi, bin rise through di ranks to get to im current post of Assistant Director-General of di Service.

According to di DSS, Oga Ajayi na correct and versatile intelligence officer.

E enta di service for 1990 as a cadet officer.

“Di new DG don receive several trainings for different areas of management, security leadership, critical training, human resources, among odas from within and outside di kontri,” di security agency tok.

E also don hold many command positions wey include di State Director of Security (SDS) for Rivers, Bauchi, Enugu, Bayelsa and Kogi states.

Ajayi na diligent, resilient, urbane, proactive and analytical pesin. Di DSS say e dey come di new position wit experience, capacity plus plenty goodwill.

Oga Tinubu say im expect say di new security chiefs go work diligently to reposition di two intelligence agencies for beta results.

E charge dem to bring dia experience to bear in tackling di security challenges wey dey confront di kontri through enhanced collaboration wit sister agencies and in surgical alignment wit di Office of di National Security Adviser (ONSA).

Source