Why you fit witness fuel queue for filling station reach next week

Pipo gather for filling station to buy petrol

Getty Images

Fuel queues for Nigeria filling stations fit still continue across di kontri for some more days, as di 10 days #Endbadgovernance protest dey near im final days.

Dis na sake say, di 10 days protest lead to di limited supply of petrol to filling stations across di kontri, Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria (IPMAN) tok.

Although di protest no directly affect supply in any way, oil marketers for di kontri decide to play safe during di days of di protests.

Ipman tok-tok pesin, Ukadike Chinedu, tell BBC Pidgin say, di queues wey still dey no be sake of say dem no supply oil at all to fuel stations, but say dem dey do skeletal operations.

Oga Ukadike explain say, di oil marketers join bodi bin agree for one national council meeting say, dia members no go take part for di protest and also, dem go monitor di situation as e dey go.

E say dem no want di kind tori wit k-leg wey bin happun during Endsars protest of 2020 to repeat imsef.

“Instead of wetin don happun to us during Endsars we need to dey more careful.

“Dat na why some depots no load, some trucks no move, sake of vandalization and burning of di trucks,” im tok.

Although di protest dey peaceful for Lagos so far, but residents of di state still dey queue to buy fiuel since di days wey end di month of July.

“Di reason why fuel queues dey Lagos be say some fuel stations bin no go work sake of security, dis na sake of fear make protesters no wunjure dem, incase any gbege break out” .

Di tok-tok pesin further explain say e go be one high risk to open filling stations, especially for locations wia di protests don cause gbege.

“For now, operation dey skeletal, my belief na say immediately afta di strike we go go into work and case go normalise”.

According to Oga Ukadike, Ipman president, Alhaji Abubakar Migandi, bin don already advise di oil marketers join bodi make dem no take part for di protest.

E say fear dey as nobodi bin ready to put dia trucks for roads wen protest dey go on.

But as di situation don dey improve gradually, e say dem don begin dispatch trucks to deliver fuel to oda parts of di kontri.

Protesters for di kontri bin enta road for Lagos, Kano, Oyo, Rivers, FCT, Jigawa, Sokoto, Zamfara and oda states across di kontri to do Hunger Protest against di economic hardship for di kontri.

Plenty security agents bin full ground across di kontri to beef up security for di protest.

But di protests wey bin start peaceful later turn violent for some states for northern Nigeria and dis one cause looting and destruction of properties and shooting wey result for lose of lives.

Nigeria President Bola Ahmed Tinubu, bin address di protesters to “suspend dia protests and create room for dialogue” for one nationwide boradcast.

Di president also ask security operatives to “kontinu to maintain peace, law, and order in our kontri by following di necessary conventions on human rights, wey Nigeria sign to be part of.

Di increase for price of oil still be di major cause of di economic gbege for Nigeria.

But oil marketers say di situation affect dia sales too as many citizens don find alternative to use of oil wey in turn affect sales of oil across di kontri.

Source