Emergency workers on high alert afta two-storey building collapse, flash floods threaten Lagosians

Pipo dey waka inside flood

Getty Images

Di Lagos state emergency agency don warn say make pipo avoid travels wey no dey important during dis period of heavy rain fall and flash flood.

Di advisory na sake of one heavy rainfall wey bin start around early mor-mor 3:00am on Wednesday bin cause gbege across di state.

Oga of di agency, Olufemi Oke-Osanyintolu for statement tok say di agency and oda key responders dey on high alert.

Emergency workers rescue seven pipo afta two storey building collapse for Mushin area of di Southwest state.

Di response team say dem ansa one call for help around 9:37am for No 12 Cameroun street Mushin wia dem rescue three females and four males wey now dey hospital for treatment.

Oke-Osanyintolu say Lasema search and rescue team afta dem search di rubble fit confam say no victim still dey under di building.

E tok say make pipo stay calm as di flood already don begin disappear.

House wey flood enta

BBC

Taiwo Ajisafe wey dey live for Iyana oworo area of Lagos no fit go work sake of di heavy rain and serious flood for her area.

Taiwo tok say she bin return to her house so she go fit protect her three pikin dem from flooding for her house wey dey witness constant flooding afta heavy down pour.

Workers across di state bin hook for bus stop as no vehicles dey road to commute dem to dia destination sake of how flood don take over di roads.

States wey go witness heavy rains

Nigerian Meteorological Agency (NiMet) bin don predict say 13 states of di kontri go witness heavy rainfall for for days wey end di month of June.

Di agency, say di state wey dey affected fit witness flash floods for roads, bridges and low-lying areas wey fit cause traffic.

Di warning na sake of Madden-Jullian Oscillation wey sabi pipo say go dey strong for West Africa.

Niger, Plateau, Benue, Kaduna, Taraba, Delta, Imo, Cross River, Akwa Ibom, Rivers

Bayelsa, Ekiti and Osun states

Below na di states wey Nimet fit witness light to heavy rains

Lagos, Edo, Kano, Borno, Zamfara, Gombe, Adamawa, Kogi, Kwara, Nasarawa, Ogun

Oyo; Ondo, Enugu and Ebonyi

Source