Super Eagles coach Finidi George don resign?

Finidi George

Getty Images

BBC News Pidgin fit confam say Finidi George don resign from im position as Super Eagles Head Coach.

Though di Nigeria Football Federation neva officially comment on di resignation. And e neva clear if dem go accept di resignation.

Dis dey come afta di NFF bin tok say dem go hire a foreign technical director for di Super Eagles.

Dem make dis decision afta one emergency meeting of di NFF Executive Committee on Wednesday 12 June.

“Di Executive Committee resolve to employ expatriate Technical Adviser for di Super Eagles in di coming weeks, ahead of di AFCON qualifiers and di remaining FIFA World Cup qualifying matches,” NFF statement tok.

Finidi George wey wey NFF and di Ministry of Sports for Nigeria bin unveil on 13 May, 2024 bin dey under fire.

Di 1994 Afcon Super Eagles star dey under fire sake of di results e get from di 2026 World Cup qualifying match against arch-rivals South Africa and Benin Republic.

Nigeria bin lose to Benin Republic 2-1 for dia last World Cup qualifier.

Groups, full fixtures and favourites to win Euro 2024

Euro 2024: Who go be highest goal scorer for dis year tournament?

Group standings, fixtures of 2026 World Cup qualifiers for Africa

Earlier dem play 1-1 draw with South Africa for Uyo.

Nigeria currently dey 5th position out of 6 for Group C. Dem get only 3 points out of 4 matches. Dis na afta dem record 3 draws and 1 loss.

Finidi retire from playing for 2004 afta 15 years career, wey include im winning di 1994 Africa Cup of Nations as well as three league titles and di 1995 European Champions League with Ajax.

Im play wit oda ogbonge Nigerian footballers like Jay-Jay Okocha, Nwankwo Kanu, Emmanuel Amuneke, Sunday Oliseh and Daniel Amokachi among others.

Di former Real Betis man bin also play for Nigerian clubs like Calabar Rovers, Iwuanyanwu Nationale and Sharks of Port Harcourt before im move go Netherlands for 1993.

We dey update dis tori

Source