Killing of Alex no dey related to initiation – Ajayi Crowther University VC tok about student death

Security don begin torchlight wetin really happun as e concern di death of Alex Timilehin.

Alex na 22 year-old student of Ajayi Crowther University for Oyo state Southwest Nigeria.

Im na 200-level Mechanical Engineering student of di university wey im fellow student allegedly beat to death. Tori be say dem accuse am say e tiff fone.

Oyo state goment don call for calm among di parties wey involve for di incident.

Di state commissioner for education, Science and Technology, Prof Salihu Abdulwaheed Adelabu tok say goment dey tok wit di school authority for ways to solve di gbege.

Di goment den charge di school management to tighten security for campus so dem go fit avoid dat kind incident and make sure say di pipo wey get hand serve dia punishment.

Meanwhile, di Management of di university declare three days mourning for di death of Alex Akpo Timilehin.

Vice Chancellor Prof Timothy Abiodun Adebayo, declare di three days mourning for di university wia no lectures go take place.

E say na to honour di dead student and add say di school go embark on prayer and fasting against satanic devices sake of di incident.

Di Vice Chancellor say di university authorities bin no dey aware of di incident wey happun on Saturday until one student go report di mata to dem and dem see am for one corner wia e don already die.

Prof Adebayo say dem hear say di students beat late Alex on top accuse say e tiff phone.

“Dis na my fourth year as VC of Ajayi Crowther University, I neva imagine say dis kain unfortunate incident of dis nature fit ever occur for dis university.

“I don dey cry since di incident happun. I no know say I go fit hold dis press conference as I dey emotionally down.”

As to weda e suspect say na mata of cultism in ACU, di VC insist say no cultism dey ACU, and add say “cultists need bush to do dia initiation. We no get bushes on campus. More so, by 8pm evri day, evri student already dey dia hostels.

“I attend public university, so we know how cultists dey operate. Cultists no go kill Alex di way dem murder am.” E tok.

Di vice-chancellor say dem bin initially arrest a total of 20 students and hand dem over to di police, but afta preliminary investigations, only 12 of dem dey detained wey dem don carry go police headquarters for Ibadan, along wit di porter wey suppose dey on duty dat day.

Ajayi Crowther Univeristy gate

Ajayi Crowther University Oyo
12 students and di hostel porter wey suppose dey duty dey police detention ova di death of Alex Timilehin

Di Management of Ajayi Crowther University pay a condolence visit to di family of Akpo Alex for dia house for Kubwa Abuja.

Di Registrar Dr Babatola wey lead university delegation on di condolence visit hint say di students wey beat Alex pick am from im room and take am go anoda room wia dem beat am well-well wey lead to im untimely death over allegations say e steal phone and transfer money to play spotting bet.

“Unfortunately, none of di management members know about di beating until di next morning wen one student report am to us.

As she tok about her late son during di condolence visit, Mrs Anthonia Ozegbe say her son bin always dey ask for money despite di fact say e dey get N100,000 evri month.

“Obviously those bullies for di school always dey ask am for money. Di tin wey pain me as a mother na say e no confide in me or tell im elder sister wetin e dey go through for school.” She cry.

Source