Authority confam one pesin dead as mosque collapse, injure odas for Lagos

Mosque collapse for Papa Ajao area of Lagos

BBC

One pesin don die and five odas injure on Sunday, 26 May, wen one mosque collapse for Papa Ajao area of Lagos State.

Dis na according to one statement from di Permanent Secretary of di Lagos State Emergency Management Agency (Lasema), Dr. Olufemi Damilola Oke-Osanyintolu.

Dem report say di storey building bin collapse sake of one excavator machine wey nack am by mistake as dem dey work on road expansion.

Lasema say prayer bin dey go on wen di building collapse.

Di head of Public Affairs Unit of (Lasema) confam tell BBC News Pidgin say dem dey di scene of di incident for rescue operation.

Lasema say search and rescue of di trapped victims still dey go on wit supervision of di Permanent Secretary of di agency.

Tori be say di mosque collapse during afternoon prayer.

Oda building collapse wey don happun for Lagos

Dis no be di first time building go dey collapse for Lagos.

For April 13, 2023, one video wey go viral show di moment one seven-storey building collapse for Banana Island.

Di Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) tok say upon arrival of dia response team for di scene of di incident, dem see say one seven-storey building collapse.

Di Lagos State Goment bin say dem no approve di building wey suffer dat collapse.

September 4, 2022 bin come wit di collapse of one seven-storey building for di Lekki area of Lagos State for early mor-mor.

About 2 pipo die for di incident wit six odas wey hook for inside di house.

For early May 2022 Ebute Metta collapsed building trap dozens and some pipo die, Lagos authorities confam.

Di three-storey building on 32 Ibadan Street, Ebute Metta area of Lagos collapse on Sunday May 1 for night.

For 1 November 2021, one 21-storey building collapse for Gerrard Road, Ikoyi and kill many pipo while odas injure.

One eyewitness say around 2:25pm dem notice say evriwia bin dey shake and later di tall building fall down.

BBC News Pidgin find out say di Lagos high-rise-building na active construction site wen e crash.

One investigation blame di collapse on di negligence of di agencies wey dey responsible for di approval and supervision of di construction.

We still dey update dis tori.

Source