UK university, Home Office order Nigerian students wey no fit pay dia school fees to leave di UK

A group of Teesside University students hold placards

BBC
Teesside University students protest on campus on Tuesday morning

Teesside University for United Kingdom don stop di courses of some Nigerian students for di university and don order dem to leave di kontri.

Dis order dey come sake of di naira crisis wey make students dey struggle to pay tuition fees on time.

Authorities for Teesside University bin block students from dia studies and report dem give Home Office afta di value of Nigeria naira fall wey clear out all dia savings.

Some of di student tell BBC say dem feel suicidal as dem accuse di university say dem take “heartless” approach to those wey dey owe and no fit meet up wit payment.

One tok-tok pesin for di university tok say, failure to pay dey against visa sponsorship requirements, plus dem “no get choice” but to alert di Home Office.

Di Home Office tok say visa sponsorship decisions dey for di hand of di school.

Nigeria currently dey experience dia worst economic crisis in a generation, wey don get significant impact on Nigerian students for some UK universities.

Average inflation dey close to 30%, and di situation worsen wen di kontri president bin attempt to replace old currency wit new one.

Students hold pink protest sign

BBC
Some students accuse di university say dem dey “heartless”

Bifor dem begin dia studies for Teesside, di university bin ask affected students to show proof say dem get enof money to pay for tuition fees and living expenses.

However, those funds finish quickly sake of di crisis for dia home kontri.

Dis serious financial problems wey students already dey experience na sake of say di university change tuition fee payment plans from seven instalments to three.

A group of students, 60 of dem wey share dia names wit di BBC, begin press di university for support afta di university freeze di accounts and involuntarily withdraw di courses of pipo wey fail to make payment.

Debt collection wey di university contract reportedly call some of di students.

Adenike Ibrahim, stand against brick wall

BBC
Adenike Ibrahim bin dey close to graduating wen dem revoke she and her visa

Adenike Ibrahim bin dey close to submitting her dissertation afta two years of study wen she miss one payment and she dey kicked off her course and dem report her to di Home Office.

She later pay di outstanding fees, but she no dey re-enrolled and dem tell her say she must leave di kontri, along wit her young son.

“I did default [on payments], but I don already pay 90% of my tuition fees and I attend all of my classes,” she tok.

“I call dem and ask to reach agreement, but dem no care wetin go happun to dia students.”

She say di experience dey “terrible” and she no know wetin happun for her qualification.

“Dis dey heartbreaking for my son especially, e don dey in so much distress since I tell am,” Ms Ibrahim add.

No right to appeal

Di Home Office tell students, including Ms Ibrahim, say dem don cancel dia permission to enter UK becos dem stop to study for di university.

Di letters wey BBC see show date wey di students must leave di kontri and say dem no get “right of appeal or administrative review against di decision”.

Since e receive im letter, one masters degree student – wey no want make dem mention im name – say e bin seriously consider suicide and im no dey eat or drink.

Di university tok say dem don make “evri effort” to support affected students, as dem now don offer individual meetings wit specialist staff and bespoke payment plans wia requested.

Esther Obigwe against a brick wall

BBC
Esther Obigwe no fit tell her family wetin happun to her as she dey so embarrassed

Esther Obigwe tok say she bin try to tok to di university several times about her financial struggles but she no receive any response, until dem block her too from her studies and she receive notice to leave di kontri.

“I attend all of my classes and seminars, I be active student,” she tok.

“E dey sad, I dey on antidepressants now and I dey here alone, I no get anybody to tok to.

“For ova two months, I no fit sleep or chop well, I know no why dem dey do us like dis, we no do anything wrong.”

She add say most students “spend a lot of money to dey here”.

Jude Salubri against di wall

BBC
Jude Salubri want make di university reinstate affected students and engage more wit dem

Jude Salubri, wey dey study to be a social worker, bin dey midway through a placement wen dem tell am say im access to di university don dey suspended and im gatz comot di kontri.

Bifor den, e dey travel from Teesside to Liverpool each weekend to work 18 hours so dat im go fit pay off di outstanding fees.

“As of now, I don pay £14,000 and I get balance of £14,000,” e tok.

“I dey willing to come to an agreement as to how I go make dis payment, but I need guarantee say dem go re-enrol me to di school and restore my visa.”

Some affected students don manage to pay off outstanding fees, but di university now no fit interfere for di Home Office process, BBC understand.

One tok-tok pesin for di university say: “Teesside University dey proud to be a global institution wit diverse student population but e also dey very aware of dia obligations regarding visa issuance and compliance.

“These strict external regulations ensure say university dey fully support robust immigration system and e dey outside of di university control.”

Di spokesman add say dem dey “aware of di challenging financial situation wey some students dey face” and dem don “actively offer bespoke payment plans where requested”.

“Many of our international students don take up dis option; however, some students still default on these revised payment plans,” e tok.

Di Home Office tok say decision to offer or withdraw visa sponsorship rest wit di sponsoring institution.

One tok-tok pesin say wherever a visa was shortened or cancelled, individuals fit “take steps to regularise dia stay or make arrangements to leave di UK”.

Source