‘I wan reach di top, but I no fit get dia wit crutches’ – Amputee football coach

‘I wan reach di top, but I no fit get dia wit crutches’ – Amputee football coach
The British Broadcasting Corporation

Plenti pipo dream to become footballers for di future.

But all of dem neva fit fulfil dat dream.

One of dem na amputee coach, Abdul Aziz Abubakar wey dey train di next generation of footballers for Ashaiman for Ghana.

Abdul Aziz don dey play grassroots football for young revelation football club since im be thirteen years bifor im get car accident for 2018.

Na so dem cut one of im legs. Now im dey use crutches to waka.

Abdul Aziz tok BBC News Pidgin say dat accident don change im life.

“Dis my leg don deprive me of achieving plenti tins, especially for my football career.”

“If I wan go somewhere sef, how I go waka reach di place neva easy,” di young coach tok.

Abdul Aziz start to coach young footballers

Abdul Aziz Abubakar

BBC

Since im realize say im no fit to continue to play football wit one leg, im decide to try somtin else.

“Now I no fit to play again so I gatz impact my talent to di young ones for dis club wey I dey inside.”

Dat decision to start to dey coach sef neva dey easy.

Abdul Aziz tok BBC News pidgin say “di time wey I start to coach, some pipo tok say I no go fit make am.”

“Oda pipo too tok say I fit to do am, but pipo wey sabi who I be dem encourage me say make I do am.”

So far, di amputee coach dey guide di young footballers to become big stars.

But im sometimes dey miss playing di game.

“Sometimes if I see di kids playing, I feel like say make I join dem.”

“At times I fit to dey cry if I remember wen I don dey play football but now, I neva fit play.”

Im tok say sometimes di kids go tok im say make im stop dey cry.

“We go play well well so dat one day we go come help you,” e say di kids go tell am.

For one hot afternoon BBC News Pidgin visit di Ashaiman saka saka park, wia coach Abdul Aziz dey train di boys.

Di young footballers don dey happy say dia coach dey use all im time to train dem to become di next Michael Essien, Sulley Muntari, Asamoah Gyan and oda ogbonge players wey play for di black stars.

Wetin im achieve so far as coach for di club

Since Abdul Aziz start to dey coach di boys, di team don play three seasons for dia local league.

For di first season, di young revelation football club finish third for di league, wia coach Aziz use di juvenile team to win one trophy.

“I carry di third division side of di team to also qualify to di second division of di league wia dem also win trophy.”

One big tin wey dey make di amputee coach happy na wen dem call one of im players to di national U-17 team.

“One of di players I coach don move to Bechem United wia dem call am for di national U-17 and U-20 teams to play for Ghana.”

Im dey hope say more players for di club go get dia big breakthrough to play football for di national teams.

Abdul Aziz Abubakar

BBC

Abdul Aziz get big dreams

Di young coach dey hope say im go fit get di appropriate coaching licenses to certify am as a proper coach.

But most importantly, how to make im movement easy na wetin dey give am sleepless nights.

“Di dream na to get to di top but to get dia, pesin no fit to use crutches,” Abdul Aziz explain.

“How to fix cones for park for di training sef neva easy for me wit di crutches.”

“Sometimes if we don dey go some match venues, how to waka to di place na struggle.”

Despite dis challenges, coach Abdul Aziz say im get hope say di boys go make am proud.

Im add say, “wen I look at my confidence for di work, I see say if I get prosthetic leg, I fit to achieve more.”

“I get di talent, I get di passion, na wetin go make I fit to move around easily remain, but small small, tins go beta.”

Video by Monday Idara

Source