President Tinubu, oda dignitaries pay tributes to Ondo state Govnor Rotimi Akeredolu wey die afta a battle wit cancer

Govnor Rotimi Akeredolu of Ondo State don die afta im battle wit cancer.

Na early Wednesday morning informate come out say di govnor bin die for wia e dey receive treatment.

Di 67-year-old bin spend on medical leave before e return come Nigeria sake of im health in September 2023.

Plenti rumour bin surround di health of di govnor as im spend about 93 days for Germany wia im go receive treatment.

Di Commissioner for Information and Orientation, Bamidele Ademola-Olateju confam on behalf of di Ondo State goment say di death of Akeredolu na very sad one for di state.

“Mr. Governor bin peacefully depart from dis world for di early hours of today, Wednesday, December 27, 2023. Dis tragedy don leave behind a pain for our hearts.”

Di commissioner reveal say govnor Akeredolu bin die while receiving medical treatment for Germany due to complications arising from a long time battle with prostate cancer.

“Di family and di state goment go release further details regarding di funeral arrangements. Governor Akeredolu na extraordinary leader wey be say im dedication to di state and di pipo dey commendable.” Di statement tok.

Akeredolu, Senior Advocate of Nigeria (SAN), ex-president of di Nigerian Bar Association (NBA), and ex-Attorney General of Ondo State, na second-term govnor before im death.

E go on anoda medical leave for November 2023 wia e suppose get medical treatment wey go improve im health.

Chief Press Secretary Richard Olatunde, Govnor Akeredolu bin say di govnor need to dey well before e resume im official duties and na wetin e wan prioritise for now.

“A formal letter for di medical leave and a notice wey go formally transfer power according to di Nigerian Constitution go dey transmitted to di House of Assembly.

“For di absence of Govnor Akeredolu, di deputy govnor, Lucky Orimisan Aiyedatiwa, go assume di responsibilities of di govnor for acting capacity,” di statement tok.

Na di last activity wey Akeredolu bin perform be dis before tori of im death comot.

For ova two months wey di govnor of Ondo state Rotimi Akeredolu bin return from medical leave wia im go collect treatment, pipo no see am for di state wey e dey govern.

Govnor Akeredolu begin im 21-day medical leave for June 2023 wen im travel go Germany for treatment. E suppose return by July 2023, but di govnor fail to return.

Wen govnor Akeredolu no return as e promise for im letter to di state house assembly, im write to di lawmakers on 15 July again to extend di medical leave.

‘Akeredolu na fighter’ – President Tinubu

President Bola Tinubu don mourn di death of govnor Akeredolu wey e describe as a fearless defender wey dey fight for di masses.

Di president tok say late Akeredolu na man of ideas wey don teach many pipo power of action and service.

“Rotimi na man of ideas and action, im teach us di power of action and service, im bin serve di pipo wit absolute loyalty, dedication and forthrightness for Ondo state wia e serve as govnor for di last six years.

“Im footprints dey di entire landscape for di hundreds of kilometres of roads wey e build, di many schools wey im build and healthcare facilities wey e provide”.

President Tinubu describe Akeredolu as a ‘mourner-in-chief’ wey guide im pipo through period wey dem dey go through pain.

Presido add say na im bin reach out to Akeredolu to contest govnorship position for 2012 and even as e no make am for di first time, di late govnor later clinch di position for 2016 wen im win as govnor.

“Rotimi don play im role well and leave us untimely and we fit no see im kain type again. We go honour Rotimi memory and make sure say im legacy of service no dey forgotten.

Biography of Rotimi Akeredolu di 18th Govnor of Ondo State

Born on 21 July 1956 for Ondo, ‘Aketi’ as im friends dey call am do im primary school education for Akure and later go Ibadan for im secondary school.

Oluwarotimi Odunayo Akeredolu attend University of Ife (now Obafemi Awolowo University) wia e study Law and graduate for 1977.

Dem call Akeredolu to di Nigerian Bar one year after for 1978.

E serve as Attorney General of Ondo State from 1997-1999. Dem appoint am as President of di Nigerian Bar Association from 2008 – 2010

On 24 February 2017, dem swear am in for Akure as di govnor of Ondo state under di platform of di All Progressives Congress.

And e serve di state from 2017 – 2020 for im first term.

Akeredolu run for second term as candidate of di All Progressives Congress and win 15 out of di 18 Local Government Areas.

Nigeria election join bodi, Independent National Electoral Commission (INEC) declare Akeredolu winner afta dem count final results from di 18 local goment areas of Ondo State.

Wit 292,830 votes, Oluwarotimi Akeredolu party All Progressives Party beat Eyitayo Jegede of Peoples Democratic Party wey get 195,791 votes.

Aketi wear many hats and many of im contemporaries see am as strong leader wit unbending personal convictions.

Until im death, e serve as di Chairman of di Southern Governors’ Forum, one body wey get govnors of di 17 states for Southern Nigeria as members.

Akeredolu also lead im oda five colleagues for di South-West as chairman, to champion many reforms, especially for di area of security. Di one wey dey popular among dem, na di establishment of di South-West Security Network codenamed Amotekun. Amotekun bin come alive wen herdsmen dey disturb plenty south west states.

E be di voice against herdsmen attacks on farmers, and one of di strong critics of di administration of former President Muhammadu Buhari, even though dem belong to di same ruling All Progressives Congress (APC).

Aketi, be advocate of state police and restructuring, two convictions e call for before im last breathe.

More tributes for ‘Aketi’

Govnors and oda politicians don begin pay tribute to di late Akeredolu.

Ogun state Govnor Dapo Abiodun post on X, to express im condolence and tok sorry to di family and pipo of Ondo state on di passing of oGvnor Rotimi Akeredolu.

E say as di nation mourn di loss of dis remarkable leader, Rotimi Akeredolu, memory go forever shine as a beacon of hope and inspiration for future generations.

“Im legacy, grounded in compassion, justice, and progress, go endure, serving as a constant reminder of di transformative power of determined leadership.” Abiodun tok.

Di President, African Development Bank Group Akinwunmi Adesina alsoe express sadness ova di death of Govnor Akeredolu.

“You finish di race, you dey kindhearted. You serve your pipo wit commitment. May God comfort your family and di pipo of Ondo state. E tok for im condolence e post on X.

Govnor Godwin Obaseki of Edo state for im tribute describe Akeredolu as very brave and independent-minded man.

“Akeredolu na great man for all ramifications and im dey na always be a voice of reason to provide insight, direction and guidance on issues of national importance.”

Labour Party Presidential candidate for di 2023 election Peter Obi also send im own tribute wia e pray make God Almighty grant Akeredolu eternal rest.

Source