Jamb announce date for 2024 UTME

Di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) don announce di date for di 2024 Unified Tertiary Matriculation Examination, UTME.

Jamb, di body wey dey in charge of di examination to enta higher institution for Nigeria tok say di main UTME exam go hold from 19 April to 29 April, 2024.

Di board give dis informate for one statement wey dia tok-tok pesin Fabian Benjamin issue on Wednesday.

Di statement add say registration for di 2024 UTME go start on 15 January 2024 to 16 February, 2024.

Also, dem fix 7 March, 2023 for di 2024 Mock exam examination.

2024 UTME: JAMB fixes dates for registration, examination

The Joint Admissions and Matriculation Board,JAMB,says the…

Posted by Jamb official on Wednesday, November 29, 2023

Oga Benjamin for di statement explain say dem fix di dates “based on series of recommendations wey come out from one two-day retreat wit Information Technology and Management.

According to Jamb, dem go begin sell dia UTME application document from 15 January to 26 February, 2024.

Di board say dem expect candidates to begin print dia examination slips from 10 April, 2024.

According to Jamb, dem go begin sell dia UTME application document from 15 January to 26 February, 2024. But dem neva tok how much e go cost.

Di board say dem expect candidates to begin print dia examination slips from 10 April, 2024.

Jamb na di board wey dey conduct di examination for applicants wey wan go Nigerian public and private monotechnic, polytechnics, and colleges of educations.

Source