Imo state govnorship election result update

Voting don end in some polling units for Imo state for Nigeria wia di pipo dey vote who go lead dem for di next four years.

Na seventeen political parties dey participate for di election wey happun on Saturday 11 November 2023.

Di three major contenders for di Imo state election na di incumbent Govnor Hope Uzodinma of di All Progressives Congress (APC), Senator Samuel Anyanwu of di Peoples Democratic Party (PDP) and Athan Nneji Achonu from di Labour Party (LP).

Na di Independent National Electoral Commission, INEC, go declare who win.

According to di Electoral Act to win, di candidate must also get more dan one-quarter of di votes cast in at least two-third of each local goment area of di state.

Move around di map to see di results local goment by local goment wen Inec begin declare am

Source