Why six kontris go host di Fifa World Cup for di first time

Argentina National team

Getty Images
Argentina na di current World Champions

Fifa don confam say di 2030 World Cup go happun for six kontris inside three continents.

Fifa announce Spain, Portugal and Morocco as co-hosts, and di opening three matches go happun for Uruguay, Argentina and Paraguay.

Di opening matches for South America go mark di World Cup centenary as e go be 100 years since dem first play di world cup for Montevideo.

Fifa go conclude dis decision for dia congress next year.

“Inside a world wey dey divided, Fifa and football dem unite dem,” Fifa president Gianni Infantino tok.

“Di Fifa Council, wey dey represent di entire world of football, unanimously agree to celebrate di centenary of di Fifa World Cup, wey dem play di first edition for Uruguay in 1930, in di most appropriate way.

“In 2030, we go get a unique global footprint, three continents – Africa, Europe and South America – six countries – Argentina, Morocco, Paraguay, Portugal, Spain and Uruguay – go welcome and unite di world as we dey celebrate togeda di beautiful game, di centenary and di Fifa World Cup.”

Fifa also confam say only bids from kontris from di Asian Football Confederation and di Oceania Football Confederation dem go consider for di 2034 finals.

Saudi Arabia dey expected to bid to host di 2034 tournament for di first time.

Montevideo for Uruguay, di city wey host di first World Cup match in 1930, dey ready to stage di opening game in 2030 wit matches for Argentina and Paraguay to follow.

Di rest of di 48-team tournament go later move to north Africa and Europe.

If di 2030 proposal dey approve, Morocco go become di second African nation to host a World Cup, afta South Africa in 2010.

Portugal neva host di tournament, but dem play Euro 2004 for dia.

Spain host di World Cup last for 1982, wia Italy win di tournament for di third time.

As e dey happun for former World Cups, Uruguay, Argentina, Paraguay, Spain, Portugal and Morocco go qualify automatically as co-hosts.

Source