Niger Republic coup: Bola Tinubu deploy Benin president to check wetin dey occur for Niger Republic and President Bazoum

Dem swear President Bazoum in for 2021

AFP

Di African Union don condemn di unrest for Niger Republic, dem tok say e dey “unacceptable.”

Chairperson of African Union Commission Moussa Faki Mahamat for inside statement say make pipo wey get hand for di attempted coup d’etat immediately comot hand for di mata.

Also, Chairman of ECOWAS, President Bola Tinubu don order Benin Republic President, President Patrice Talon to proceed on immediate mission go Niger Republic ova di attempted coup.

Dis na part of di series of messages wey Nigeria president Tinubu dey put out via im social media handle since tori break for Niger.

On Wednesday morning sojas for Niger block di presidential palace and several ministries for di capital, Niamey, according to reports.

Dem neva fire any shots and e neva dey clear if dis na attempt by di presidential guard to seize power.

Di president office bin tweet say di guards no dey successful as dem try get support from di military for dia “anti-republican” efforts.

President Mohamed Bazoum dey im house wit im family, AFP report.

One unnamed source tell di same news agency say di move na a “fit of temper” by troops, and dem don begin tok.

Reports say di immediate former president, Mohammed Issoufou, and oda former presidents currently dey involved in tok-tok to stop di situation make e no pass e be.

“Di President of di Republic and im family dey do well. Di Army plus di National Guard dey ready to attack” those wey dey involved for dis incident, di president office add.

Di landlocked West African state na one of di most coup-prone nations for di world, e don experience four coups since independence from France for 1960, as well as plenty odas attempted coups.

Niger presidential palace

BBC
Road to Niger presidential palace for Niamey Wednesday 26 July 2023

President Bazoum, wey dey democratically elected for 2021, na close ally of France.

Di kontri last coup occur for February 2010,and e overturn di den President Mamadou Tandja.

Niger dey fight two jihadist campaigns – one for di south-west, wey enta di kontri from neighbouring Mali for 2015 and di oda one for di south-east wey involve jihadists wey base for north-eastern Nigeria.

Militant groups wey be supporters of both al-Qaeda and Islamic State dey active for di kontri.

Two neighbouring kontris, Mali and Burkina Faso, bin experience coups recently wey jihadist uprising trigger.

‘We stand gidigba wit Niger Republic’, Ecowas chairman Tinubu react

Leadership of di Economic Community of West African States (Ecowas) say dem no go accept any action wey affect di smooth functioning of legitimate authority for Niger or any part of West Africa.

Dis dey come afta reports say sojas don block di presidential palace plus several ministries for di capital, Niamey.

Chairperson of Ecowas, President Bola Tinubu for inside statement tok say di leadership of Ecowas no go tolerate any situation wey reduce democratically-elected goment of di kontri.

E say dem closely dey monitor di situation and development for Niger.

“I dey in close consultation wit oda leaders for our region, and we go protect our hard-earned democracy in line wit di universally acceptable principle of constitutionalism,” president Tinubu tok.

Di Ecowas chairman wey also double as Nigeria president add say Nigeria stand gidigba wit di elected goment for Niger and go stand to defend constitutional order.

History of coup in Niger since independence

Niger Republic gain independence for 1960, di kontri don experience four coup wey happun for di year 1974, 1996, 1999 and 2010.

Di kontri don dey under military rule for 23 years bifor dem return to democratic goment for 2011.

On 14 April 1974, Colonel Seyni Kountché, end di presidency of Hamani Diori, wey don dey rule di kontri since 1960. Colonel Seyni Kountché wey gbab di position die for 1987.

Afta, Ali Saibou wey be di Chief of the Supreme Military Council rule di kontri till 1989, e comot for im seat for 1990. From 1990 to 1993, di kontri practice transitional goment.

On 27 January 1996 anoda officer, Colonel Ibrahim Mainassara Barré commot di democratic goment for Niger. Nigeriens bin elect Mahamane Ousmane of di Social Democratic Convention as president for 1993 but im rule end afta Bare gbab di position.

For 1999, members of di presidential guards assassinate Ibrahim Barré Mainassara for Niamey, military airport.

Afta, dem practice transitional goment for nine-month until dem hold election, wey elect Mohammedou Tandia for 1999 and 2004.

Tandia hold power from 2004 till 2010.

On 18 February 2010, soldiers under Salou Djibo, wey call demselves di Supreme Council for the Restoration gbab power from Mohammedou Tandia, democratic elected government. Di kontri transition into democratic rule for 2011 till date.

Niger President Mohamed Bazoum – Profile

Dem swear in Mohamed Bazoum as Niger President for April 2021. E take ova from Mahamadou Issoufou wey don be di head of state since 2011.

Dem declare Bazoum winner of Niger 21 February 2021 presidential election according to di final results, wey di opposition contest and lead to violent protests.

Di lead up to im inauguration dey mark by post-election violence, deadly jihadist attacks and one controversial coup attempt on 31 March.

Bazoum na di presidential candidate of di ruling Niger Party for Democracy and Socialism (PNDS-Tarayya) and e win di first round of di election on 27 December 2020.

E dey considered as di political heir of President Mahamadou Issoufou.

Bazoum enter politics for 1990 as co-founder of di PNDS-Tarayya party. Since then, e don hold various ministerial positions, wey include minister of state and minister of foreign affairs.

E play ogbonge role for di re-election of im long-time ally President Mahamadou Issoufou for di 2016 election, and afta di election, dem appoint am as minister of interior.

E hold di position until June 2020, when e comot from goment to focus on di first round of di 2020 presidential election.