Presidential election tribunal updates: Bola Tinubu, Inec, APC give dia defense

Nigeria President, Bola Tinubu go open im defence for di Presidential Election Petition Court wey dey siddon for Abuja on Tuesday.

Tinubu na di second respondent for di petitions wey Labour Party Peter Obi and Atiku Abubakar of the Peoples Democratic Party bring before di court, wey challenge di declaration of Tinubu as president afta di 25 February election.

Di first respondent, di Independent National Electoral Commission, INEC, bin don open and close dia defence on PDP petition on Monday.

Inec call only one witness and tender some documents, wey be Certified True copies for court.

Di Presidential Election Petition Court wey dey seat for Appeal Court, Abuja resume session on Monday 3 July, 2023.

Dis na afta dem go on break on 30 June, 2023 wen di petitioners, Peter Obi of Labour Party and Atiku Abubakar of di Peoples Democratic Party finish dia case.

Wetin happun for court on Monday

Di one and only witness dem call na Dr Lawrence Bayode wey dey live for Abuja and work wit Inec as Information Technology practitioner.

Di witness wey day im don work wit Inec for di past 24 years, bin don depose im statement on 11 April, 2023.

Inec lead counsel Abubakar Mahmood refer to paragraph 4 of di witness statement wia im point out a cloud trail log – Mahmood tender di clowd log as evidence bifor di court.

Oda respondents for di matter including president Bola Tinubu and di ruling APC no object court admission of di documents as evidence.

However, lead Counsel to Atiku Abubakar of di Peoples Democratic Party, Chris Uche say make court no accept di evidence.

During di cross examination of di witness by all di parties, lead Counsel to PDP, Chris Uche tender di European Union observation mission final report.

Im ask di witness if im don see am, di witness say yes but im neva see di content of di report.

Even though di respondents no agree for court to accept di EU report as evidence, dem make di witness to read out Page 6 and di first sentence of di report wey say “only 31 percent of di results formally uploaded on IREV server Dey mathematically correct”.

Di witness as im dey tok say no be all di results wey dey uploaded bifor dem declare Bola Tinubu as President, note say dem (Inec) no send any formal report to Amazon Web Services about di issues wey dem bin dey face.

Di five-man panel adjourn to Tuesday 4 July , 2023 for oga Tinubu wey be di second respondent to open im defence against Atiku Abubakar.

Inec to call three witnesses in three days against Obi petition

Inec fail to open dia defense for di Presidential Election Petition Court (PEPC) against Labour Party and dia presidential candidate Peter Obi on Monday.

Di commission plan stop following dia absence of dia first witness.

Inec wey be di first respondent for di petition by Peter Obi and di Labour Party (LP), bin dey scheduled to open dia defence on Monday.

Wen dem mention di case, Abubakar Mahmoud a Senior Advocate of Nigeria and Lawyer to Inec tell di court say im plan to call three witnesses within three days.

INEC VS Labour Party as e waka on Monday

Labour Party Vice Presidential candidate Datti Baba-Ahmed siddon for court on Tuesday wit oda pipo - 03 July 2023

BBC
Labour Party Vice Presidential candidate Datti Baba-Ahmed siddon for court on Tuesday wit oda pipo

Inec begin dia defence on Monday and counsel to Inec, Abubakar Mahmood tell di panel of Judges say dem go bring three witnesses one for each day.

Im also inform di court say di witness wey suppose come on Monday get emergency family problem.

Im beg court to adjourn am till on Tuesday 4 July 2023.

“My Lords we get three witnesses but di one wey suppose come today just call. me say im get emergency domestic issues so im no go fit come.

I pray di court to adjourn dis mata till tomorrow,” e tok.

All di oda respondents agree to di plea and court adjourn di hearing to continue on Tuesday.

Lead counsel to Labour Party, Livy Uzoukwu tell court say “Inec no ready for di defence and im dey surprised say dem no let dem know about dis development”.

Meanwhile, di case between Inec and Atiku Abubakar of di Peoples Democratic Party go start by 2pm Tuesday.

More pictures from court on Tuesday

Lawyers exchange pleasantries for court

BBC
Lawyers exchange pleasantries for court
Cross section of lawyers for court

BBC
Cross section of lawyers for court