Chelsea name ex-manager as boss until end of season

Frank Lampard bin go Stamford Bridge on Tuesday for Chelsea draw wit Liverpool

Getty Images

Frank Lampard don get di appointment as Chelsea manager until di end of di season – just over two years wey di club sack am.

Di 44-year-old, wey be di club record goalscorer, dey takeover sake of Graham Potter sack on Sunday.

Lampard, wey no get work since Everton sack am for January, don coach Chelsea before from July 2019 until January 2021.

Chelsea dey11th position for Premier League and dem go play Wolves on Saturday.

Dem dey 14 points behind fourth-placed Manchester United, even though dem don spend more dan £550m on new players dis season, but Chelsea also qualify for di Champions League quarter-finals and na Real Madrid dem go play for di first leg on Wednesday.

Co-owners Todd Boehly and Behdad Eghbali say former midfielder Lampard go take charge while dem continue an “exhaustive process” to find a permanent manager.

“We want to provide di club and our fans with a clear and stable plan for di remainder of di season,” statement tok.

“We want to give ourselves every chance of success and Frank get all of di characteristics and qualities we need to drive us to di finish line.”

For im previous managerial spell for Chelsea, Lampard coach di club wen dem bin ban dem from any transfer, but im guide Chelsea to fourth-place finish and di FA Cup final for im first season in charge.

Afta Chelsea spend £200m di following summer on seven major signings, including current players Ben Chilwell and Kai Havertz, im no fit keep to im early promise na why former owner Roman Abramovich sack am. Di club bin dey ninth for di Premier League, and na only two of im previous matches im win inside eight games.

Na Thomas Tuchel replace am, wey lead Chelsea to victory for di Champions League final four months later.

After im chop sack from Chelsea, Lampard waka go Everton as oga for January 2022.

Im guide dem to safety from relegation last season but dem remove am eight to im one-year anniversary for im position after nine defeats for 12 Premier League games dis campaign.

Lampard bin showface for Stamford Bridge on Tuesday for Chelsea’s 0-0 draw with Liverpool, wen Bruno Saltor bin dey in charge.