Tottenham hold down Arsenal for North London derby

Arsenal draw 2-2 wit Tottenham for north London derby

Getty Images

Di first north London derby dis season wey shele on Sunday afternoon for Emirates stadium on 25 September between Arsenal and Tottenham end for 2-2.

Arsenal bin jam Tottenham for dia home ground for Premier League and di match no get winner.

Arsenal and Tottenham get 14 points but Spurs dey ahead of dem for table sake of goal difference.

Di two teams dey unbeaten so far dis season afta five league matches.

Arsenal bin take di lead afta 26 minutes wen Bukayo Saka shot bin dey deflected into im own goal by Spurs defender Cristian Romero.

Arsenal manager Mikel Arteta bin make di big decision by keeping David Raya in of goal ahead of Aaron Ramsdale and im justify dat faith wit two fine saves from Brennan Johson as Spurs go for equaliser.

Raya suppose do better wen Spurs level three minutes before half-time. Wetin im do be say im claw away one cross wey allow attack to Kontinu – den end am wit James Maddison crossing for Son Heung-min to equalise wit a good finish.

Arsenal restore dia lead afta 54 minutes wen Romero bin dey penalised for handball afta di intervention of di Video Assistant Referee, Saka score rom di spot.

Spurs show dia new positive approach under manager Ange Postecoglou for im first North London derby as dem come back on terms almost instantly wen Jorginho, as half-time substitute for di injured Declan Rice, lose possession to Maddison, wey set up Son for correct finish as im level di score.

Arsenal draw 2-2 wit Tottenham for north London derby

Getty Images

Second Half

FULL-TIME

Arsenal 2-2 Tottenham

90+11 mins

Na di end of match be dis.

90+11 mins

Pedro Porro take di resulting corner wey dey well defended.

90+10 mins

Dis na chance for Richarlison as im produce one stunning snap shot from di edge of di box!Di goalkeeper bbin dey lucky as di ball go just wide of di right post.

90+9 mins

Kai Havertz cross into di box near di side line, but im no connect as im want and di well-organised defence clear am comot.

90+9 mins

Cristian Gabriel Romero make one rough challenge and Robert Jones blow im whistle for foul.

Arsenal vs Tottenham

Getty Images

90+7 mins

Di referee signal say time don reach for substitution and Emile Smith Rowe go replace Bukayo Saka.

90+6 mins

Richarlison get to di rebound just outside di box, but one of di defending players block im attempt.

90+4 mins

Kai Havertz send one cross into di box, but di opposition defence clear di ball away to eliminate di danger.

90+3 mins

Richarlison dey for offside position afta dem play di ball to am and di linesman raise im flag.

90+3 mins

Martin Odegaard play di corner, but dem clear am comfortably.

90+2 mins

Reiss Nelson whip in di corner, but one of di defending players get head and am intercept am.

90+2 mins

Bukayo Saka find im way to a rebound on the edge of the box, shoot to di bottom left corner, but di keeper dive and deny am. Di referee points to di corner flag and Arsenal go take one corner.

90+1 mins

Martin Odegaard whip in one cross from di corner, but Guglielmo Vicario dey well positioned and punch di ball away.

Arsenal 2-2 Tottenham

90 mins

Di fourth official show 10 min. of added time.

89 mins

Reiss Nelson float di ball in from di corner but dem intercepted am.

88 mins

Reiss Nelson send one pass into di box, but dem block and clear im attempt.

Premier League live update: Arsenal 1-1 Tottenham

BBC Sport

87 mins

Di ball rebound out to Kai Havertz for di edge of di box. Eimmediately strike for goal, but send di ball high ova di bar.

86 mins

Jorginho take di corner but im fail to find any of im teammates.

85 mins

Bukayo Saka take di corner, but di opposition defence dey ready and clear di ball to safety.

85 mins

Reiss Nelson get on di end of one pass for di edge of di box but dem block im shot.

83 mins

Di game dey interrupted. Destiny Udogie don violate di rules as im deybattle for di ball. Dem no make any protest or gesture and im know wetin im do.

81 mins

Bukayo Saka try to find Eddie Nketiah, but im put too much power on di pass.

81 mins

Di attendance na 60,156.

78 mins

Na change be dis. Heung-Min Son leavee di pitch and Richarlison enta as substitute.

78 mins

Na change be dis. James Maddison dey go off and Ange Postecoglou give di last tactical orders to Pierre-Emile Hojbjerg.

77 mins

Di referee signal say time don reach for substitution and Reiss Nelson dey come onto the pitch as Gabriel Jesus no fit continue afta im get injury.

77 mins

Eddie Nketiah pass di ball from di edge of di box in order to find im teammate, wey dey in good scoring position, but di defender block di pass and spank di ball to safety.

76 mins

Ben White send one cross into di box, but Guglielmo Vicario come off im line to gada di ball.

76 mins

Pape Matar Sarr bring i opponent down with tackle and Robert Jones blow im whistle for foul.

75 mins

Pedro Porro whip di ball in from di corner, but one of di defenders clear am.

75 mins

Dem show Cristian Gabriel Romero yellow card sake of say im tok out of turn to di referee. E fit even worse!

74 mins

Pedro Porro send one pass into di penalty area, but di opponent manage to cut am out.

73 mins

Martin Odegaard take di corner kick but di ball only find di head of one opponent.

73 mins

Kai Havertz whip one promising cross into di box, but di opposition defence intercept di ball.

72 mins

E be like say James Maddison dey alright and okay to carry on.

71 mins

Pedro Porro swings one cross into di box, but e dey too close to David Raya, wey smothers di ball.

71 mins

Pedro Porro put one cross into di box from di corner but no panic from di opposition and dem easily clear am.

69 mins

James Maddison dey ask for medical treatment afta im get injury.

69 mins

Na big chance! Heung-Min pick up inch-perfect pass inside di box and fire di ball a whisker wide of di right post.

69 mins

Yves Bissouma dispossess di attacker wit slide tackle, but di referee blow im whistle for foul. One free kick to Arsenal.

67 mins

Dem penalise Eddie Nketiah.

67 mins

James Maddison float di free kick into di box, but di first man easily clear am.

66 mins

Gabriel bring im opponent down. Robert Jones get clear sight of am and blow im whistle for foul.

63 mins

Dem wan comot Brennan Johnson sake of injury. Ange Postecoglou send Manor Solomon to di pitch.

63 mins

Brennan Johnson dey get really tough time right now. We dey try find out how serious im injury be.

61 mins

Bukayo Saka break past challenges inside di box, but put too much pace on im pass to Ben White.

57 mins

Dis yellow card dey deserved. Di tackle by Kai Havertz bin dey harsh and Robert Jones no hesitate to show im yellow card.

55 mins

Goal – 2:2! James Maddison tee up Heung-Min Son (Tottenham) inside di box and im roll di ball into di bottom left corner and past David Raya.

54 mins

GOAL! Dat na perfect strike from di spot by Bukayo Saka high into di middle of di goal, giving goalkeeper Guglielmo Vicario no chance!

53 mins

Bukayo Saka go take di responsibility and im don already dey prepare di ball.

53 mins

Referee Robert Jones awards one PENALTY afta di VAR review!

51 mins

E don tey since dat incident for di box, but di ref fit don recieve some information as im makes di VAR signal. Im go review dat earlier penalty shoot! What a chance for Arsenal.

50 mins

Cristian Gabriel Romero appear to handle di ball in di box, but di ref turn down di penalty appeals and wave play on!

49 mins

Bukayo Saka go ova to take di corner kick and e be like say im go send di ball into di penalty box.

49 mins

Pedro Porro swing am in and James Maddison get on di end of am, but David Raya show good awareness and come off im line to block di move.

47 mins

Neat passing move from Arsenal so dem go fit create new attacking opportunities.

57 mins

Dejan Kulusevski hold im opponent to prevent am from getting di ball and di referee blow im whistle for foul.

46 mins

Mikel Arteta prepare one substitution. Declan Rice comot for Jorginho.

46 mins

Substitution. Kai Havertz of Arsenal replace Fabio Vieira.

46 mins

Di players don come back on di pitch and di second halfwan start now.

First Half

HALF TIME

Arsenal 1-1 Tottenham

45+5 mins

Robert Jones blow im whistle to signal di end of di first-half action.

45+1 mins

Dem award Yves Bissouma yellow card sake of im sharp discussion wit di referee. Make im relax or dem go send am off.

45+1 mins

Dem book Pape Matar Sarr afta im bring down one opponent. Robert Jones get easy decision to make.

45 mins

Dem go play 4 mins of stoppage-time.

45 mins

Pape Matar Sarr one teasing cross into di area, but David Raya intercept di ball..

42 mins

Heung-Min Son of Tottenham latch onto one sweet pass and score. Im shot go in off di bottom of di right post. Fabulous goal!

39 mins

Pedro Porro pass di ball onto Heung-Min Son, but one of di defenders dispossess am.

38 mins

Brennan Johnson collect great pass inside di box and miss one sitter. Im shot dey directed towards di left post, but di goalkeeper pull off one marvellous diving save and deny am.

37 mins

Martin Odegaard one correct strike from di edge of di box. Im dangerous effort towards di left post dey blocked by Guglielmo Vicario, wey pull off superb save to keep di ball out of di net.

37 mins

One pass by Brennan Johnson (Tottenham) end up for no man’s land, and di attacking effort bin end.

34 mins

Gabriel Jesus send one cross into di box, but Guglielmo Vicario come off im line to gather di ball.

33 mins

One clumsy foul by James Maddison and Robert Jones blow im whistle.

32 mins

Gabriel Jesus strike di ball wey rebound to di edge of di box. Im attempt go narrowly ova di crossbar. Di ball go out of play and Tottenham go get goal kick.

31 mins

Opposition defence clear di resulting corner from Bukayo Saka. Di ball dey out of play. Arsenal win one corner kick.

31 mins

Dem clear one cross wey Fabio Vieira play into di box.

30 mins

Fabio Vieira don pick up minor injury, but e be like say e go dey able to continue.

29 mins

Fabio Vieira dey feel pain and go receive medical treatment afta di referee signal di physio to come onto di pitch.

26 mins

Cristian Gabriel Romero of Tottenham concded one unfortunate own goal wen im attempt to smack di ball away, but instead im send am inside di right post of im own goal.

25 mins

Na James Maddison deliver but no be one of im best and dem easily clear am.

24 mins

E be like say James Maddison bin wan take quick free kick, but instead im dey go send di ball inside di penalty box for im teammates.

24 mins

Fabio Vieira clearly hold im opponent to prevent am from getting di ball and di referee immediately stop play.

23 mins

Martin Odegaard trip one opponent wit slide tackle. Robert Jones stop di game and e fit give am card, but eventually decide to give am only warning.

21 mins

Heung-Min Son dey forced to stop im forward run afta di linesman catch am for offside.

19 mins

Yves Bissouma (Tottenham) take snap shot from di edge of di box after one rebound, but im effort na waste as e goe high ova di bar.

19 mins

Pedro Porro serve up one nice cross, but David Raya punch di ball away.

17 mins

Dem penalise Heung-Min Son sake of holding. Robert Jones signal one set piece.

17 mins

Bukayo Saka take di corner kick and send one lovely ball into di penalty area, but di opposition defence dey ready and dem knock di ball to safety.

16 mins

Guglielmo Vicario make one sensational save to block one great chance. One rebound fall to Eddie Nketiah of Arsenal inside di box and e strike goalwards, but di ball end up for di keeper gloves instead of di right side of di target.

15 mins

Martin Odegaard of Arsenal go into di book for bad language. Im vulgar comments fit make am worse. Luckily for am, na yellow card.

15 mins

Robert Jones show yellow card to Destiny Udogie of Tottenham for im blatant foul.

14 mins

Gabriel Jesus run onto one lofted ball into di box, but e hit weak shot towards di top of di goal wey Guglielmo Vicario easily deal wit.

12 mins

Bukayo Saka of Arsenal bring one opponent down and Robert Jones interrupt di game.

11 mins

Dejan Kulusevski slide tackle, but referee Robert Jones blow for foul.

10 mins

Gabriel Jesus mnage to dispossess im opponent of di ball, but im commits foul in di process and di referee blow im whistle.

9 mins

Martin Odegaard swing one promising cross from di free kick, but one of di defenders do better job to block di danger.

8 mins

E be like say Martin Odegaard bin wan take quick free kick, but instead im dey go send di ball inside di penalty box for im teammates.

8 mins

Micky van de Ven pull di jersey of one of di opposition players and Robert Jones blows im whistle for foul.

6 mins

Poor challenge! Dem penalise Cristian Gabriel Romero sake of say im trip, and Robert Jones blow im whistle.

6 mins

Bukayo Saka receive one sweet pass from Martin Odegaard, but dem stop di advance.

4 mins

Di assistant referee raise im flag and di referee blow im whistle. Heung-Min Son of Tottenham put di ball into di net, but dem flag am for offside.

3 mins

James Maddison go ova to take one corner kick afta one of di defenders make good clearance.

3 mins

Brennan Johnson dribble into space and find imself for one shooting position, but dem block di shot wey im play from di edge of di box. Tottenham force one corner. Dem send men into di box.

2 mins

Robert Jones blow di whistle, Martin Odegaard of Arsenale dey penalised for foul.

1 min

Pape Matar Sarr commit minor foul to interrupt di attacking move of im opponent and di referee wanr am say im go get yellow card if im try am again.

Arsenal 0-0 Tottenham

1 min: KICK OFF

Match don start

Source