I neva campaign for any politician before – Oyedepo

Di founder of Living Faith Church Worldwide alias Winners Chapel, Bishop David Oyedepo, say im neva campaign for any politician or try to convince any group to vote dem.

Di Clergy man tok dis one during one service for im church headquarters for Ota area of Ogun State.

E say “I neva campaign for anybody or tok to anybody on dia behalf and I no go do am till I go heaven.”

Bishop Oyedepo reaction come afta one unverified audio go viral wey be alleged phone conversation between im and di presidential candidate of di Labour Party, Peter Obi.

Di Winners Chapel founder no refer to di details of di audio in any way but e insist say im neva campaign for any politician bifor.

Di viral leaked audio tape between di Labour party presidential candidate for di 25 February election, Peter Obi and di founder of di Living Faith Church aka Winners Chapel, Bishop David Oyedepo don dey confam to be real.

Di toktok pesin for Labour Party Obi-Datti Presidential Campaign Council, Kenneth Okonkwo confam am inside one thread on Twitter early mor=mor on Sunday.

Inside di audio, Obi, wey be 61 years dey tok to Oyedepo, aged 68 about di presidential election.

Di content of di leaked conversation wey dey on di election don generate plenty reaction since e enta di social media space.

None of di two men don come out to personally tok about di audio.

Local report say di call happun on di eve of di election.

Dis dey come as some Nigerians still no dey happy with di conduct and outcome of di presidential wey produce Bola Ahmed Tinubu of di APC as di president-elect.

Obi, im party, Atiku Abubakar and im party PDP plus odas dey challenge di election for court sake of say dem believe say some mago-mago happun during di polls.

Oga Okonkwo for di tweet explain say Obi no dey encourage religious war as di ”oda party dey do”.

“Firstly, di context of di conversation dey aptly put by Bishop Oyedepo when e said, ‘All Nigerians get equal stake for dis nation, nobody get di right to claim say e dey dash something to someone’.

”H. E. Peter Obi dey simply urging di Bishop to help am push dis message of equal stake of all Nigerians for di Nigerian project to im pipo and di christiandom because di oda party dey carry on dis campaign as if na religious war”

E explain futher: “To drive home dis point, e inform am say e bin visit di traditional ruler of Offa, di Olofa of Offa, wey be Muslim, but wey advised Obi to get di support of Oyedepo and be assured of im own support. No Politician ever go visit di Olofa of Offa. E dey clear to everybody say di APC political party wey get Presidential Candidate, Vice Presidential Candidate, Senate President, Speaker of di House of Representatives, Deputy Speaker of di House of Representatives, National Chairman of di Party all from one religion at a time di CJN be Muslim na di Party wey don declare religious war on Nigerians and we gatz all rise up together to fight dis unconstitutional act of religious intolerance of oda religions by APC.

“I go around wit Obi on campaign train and never see am discriminate against any religion. Of course no fit cos im Vice na Muslim unlike APC. I resign from APC becos of dia religious intolerance. Make Nigerians disregard any insinuation of religious bigots about dis tape.”

Wetin dey inside di leaked audio tape

Inside di audio wey BBC never comfam independently, Obi say “Daddy, I need you to speak to your pipo for di South-West and Kwara, di Christians for di South-West and Kwara,”

E tok further “Dis na religious war.” to which Bishop Oyedepo respond

“I believe dat, I believe dat, I believe dat,”

Obi continue ”Like I bin dey tok am : if dis work, you pipo no go ever regret di support,”

“We look forward to God intervention,” Bishop Oyedepo respond.

‘Wetin I dey do na to advice leaders’

Bishop Oyedepo say true-true politicians dey come to am for prayers.

E say di politicians na from different political parties and wetin im dey do na to pray for dem and advise dem.

“E no get any party wey neva come to me for prayers and and advice.

“I advise dem. Some, dem no dey take. Doz wey dey follow my advise, e dey work for dem, do wey say no still struggle.

“If you still come again, I go still tell you, nothing go change.”

Many of Oga Obi supporters aka ‘Obidients’ no believe say di audio dey real and dey describe am as ‘deep fake

Some oda Nigerians no share di same opinion dat di audio na fake.

Many don enta dia Twitter handle to express diappointment about di audio and also condemn di Oga Obi for im comment.

Obi dream to become president one day don die- Keyamo

Spokesperson for Campaign Council of the President-Elect, Festus Keyamo for im recation to di viral audio say God don expose Obi for declaring a ”religious war”.

Keyamo say Obi dream to become President one day don die.

”Having confam di authenticity of wetin now dey known as di Peter Obi ‘Yes-daddy’ audio, I think di real culprit for hiana di so-called ‘men of God’ wey allow demsef to be used by an unscrupulous politician to seek to inflame religious passions in our dear kontri in di name of politics.”

”As for Peter Obi wey declared an election a ‘religious war’ for a multi-religious and multi-ethnic kontri like ours, di real God don expose am and im dream to be Nigeria President one day now don die natural death.