Appeal Court uphold Ademola Adeleke as governor of Osun state

Court of Appeal for Abuja don set aside di tribunal judgment wey bin remove Govnor Ademola Adeleke from office.

Di three man panel of Judges wey Mohammed Shuaibu lead overrule di decision of the Tribunal.

Di Court of Appeal hold say di tribunal dey wrong to reach conclusion on over voting on oral witnesses as dem consider information wey dey di BVAS machine and voters register.

Court say di voters register na di foundation of any election and di voters register also dey central on di 2023 election.

“Dia appeal get merit and so we go allow am” court tok.

Court also order Gboyega Oyetola and di All Progressives Congress, APC to pay Ademola Adeleke and di Peoples Democratic Party, PDP, Five Hundred Thousand Naira each N500,000, as fine.

Wetin bin don happun so far?

For di last hearing for di Court of Appeal, di three-member panel wey M.F Shuaibu lead reserve judgement afta di panel of judges listen to di lawyers of Govnor Adeleke of di Peoples Democratic Party, PDP and former All Progressives Govnor, Gboyega Oyetola.

Govnor Adeleke bin file suit against di decision of di election petition tribunal wey cancel im election as govnor of Osun State.

Inec bin declare Adeleke as di winner of di election afta e poll a total of 403,371 votes.

According to Inec, Adeleke bin win 17 out of di 30 local goment areas for di state.

But di election petition tribunal, inside dia split decision of two-to-one, cancel di election and declare Mr Oyetola of di APC as di winner of di election.

Di tribunal wey Terste Kume lead direct Inec to withdraw di certificate of return wey dem give Adeleke and im deputy, Kola Adewusi, afta dem don swear dem into office.

Di Tribunal also direct say make dem give di certificate of return to Mr Oyetola.

According to Mr Kume, di Tribunal hold say di way dem do di govnorship election no comply with di Electoral Act of Nigeria. Di tribunal also tok say over-voting dey for dat election.

Senior Advocate of Nigeria Onyechi Ikpeazu na im represent Ademola Adeleke while anoda Senior Advocate of Nigeria Lateef Fagbemi represent Gboyega Oyetola.

Oyetola na di former govnor wey bin contest to comeback as govnor but im loss di election.

Govnor Ademola Adeleke na di Appellant, Gboyega Oyetola, All Progressives Congress, APC, di Independent National Electoral Commission, Inec and di Peoples Democratic Party, PDP na di first and second, third and fourth respondents.